A song made by Emmanuel Anesheshi
A song made by Emmanuel Anesheshi
Hallelujah!
God dey work oh!
When e be like say I don fall
When my strength don finish at all
When the road rough, I no fit see way
Na You dey carry me every day
When wahala wan scatter my life
When tears full my eye for night
I remember say You dey for me
Your love no dey ever leave me
When I'm down to nothing
God is up to something
When I'm down to nothing
God is up to something
Your grace dey cover me oh!
Your mercy follow me oh!
When I'm down to nothing
God is up to something
E be like mountain wey block my way
But I know say You go make am give way
Wetin man see as the end
Na where You dey start again
You turn my sorrow to dancing oh
You turn my mourning to blessing oh
I lift my hands, I give You praise
You faithful all of my days
When I'm down to nothing
God is up to something
When I'm down to nothing
God is up to something
Your grace dey cover me oh!
Your mercy follow me oh!
When I'm down to nothing
God is up to something
Glory!
God dey work!
Thank You Jesus!
Hallelujah!