A song made by PRAISE Victor
A song made by PRAISE Victor
Hmm, this one pain me sha
My baby
I remember when we start, everything dey sweet oh
Your smile dey make my heart beat, baby you complete oh
But the bottle come between us, e come scatter everything
Late nights I no come home, you dey cry, you dey calling
Wetin I dey find for bottle wey I no see for your eyes?
The way you hold me close at night, the way you dey by my side
But the drink dey control me, I dey lose myself small small
I see the pain for your face when I stumble and I fall
My baby, my baby, I nearly lose you oh
Alcohol nearly take the best thing wey happen to me
My baby, my baby, I don see the light now
No more bottle go come between me and you
You be my everything, e choke!
You give me chance after chance, but I dey mess am up
You pack your bag one night, say enough is enough
That night I cry, I beg, I realize wetin I don do
My love, my queen, I fit no survive without you
Now I dey fight my demons, I dey choose you everyday
No more apologies, I dey show you better way
We dey heal together, step by step we go dey fine
Thank you for your patience, for standing by me all this time
My baby, my baby, I nearly lose you oh
Alcohol nearly take the best thing wey happen to me
My baby, my baby, I don see the light now
No more bottle go come between me and you
You be my everything, on God!
My love, my baby
We go dey alright
I promise you