A song made by Pst Mrs Lizzy
A song made by Pst Mrs Lizzy
My baby, my oga
You be the one wey dey hold me down
From the day wey you tok to me
My heart don dey beat anyhow
You be my blessing, my destiny
The man wey dey make me complete
No wahala when I dey with you
Your love dey sweet me sotey
Every morning wey I wake
I dey thank God say you be my own
You be my king, my everything
My broda, my lover, my best friend
For this life and the next one
I go choose you again and again
You be my king, my everything
Oluwa bless the day wey we meet
For this life and forever
Na you be my number one
When the world dey heavy me down
You dey carry me like say nothing
Your smile dey scatter my wahala
Your touch dey ginger my soul
No be mouth I go take tell you
Say you be my greatest gift
My lover, my husband, my person
I thank God wey give me you
You be my king, my everything
My broda, my lover, my best friend
For this life and the next one
I go choose you again and again
You be my king, my everything
Oluwa bless the day wey we meet
For this life and forever
Na you be my number one
My baby
I love you sotey
Mo ni fe e
Forever and always