A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
This gift
Dis kind gift wey baba carry give small pikin like me,baba God you too much,baba God after you na you,witout you life no goes anybodi
Dis kind gift too much,dis kind inspiration dey sweet my belle,dey wine my brain,dey totori my body.
I salute dis baba wey hold hand,come raise am up before my enemies,even,my enemies come dey hail me,dey praise baba God.na only baba God fit do dis one.
Na so i go dey type chaka chaka!, chaka!, chaka!dey think!think!think!carry biro and paper dey write,dey calculate,dey read am,dey look am,e no easy for the head wey dey creative,e no easy for the hand wey dey scratch like fowl wey dey fine food.
Dis kind gift too much,dis kind inspiration dey sweet my belle,dey wine my brain,dey totori my body.
We go rock dis songs,we go jig am,dig am,pimp am untill every sweat dry,come sweat again and legs come dey heavy to move.
Dis kind gift too much,dis kind inspiration dey sweet my belle,dey wine my brain,dey totori my body.
Anytime wey pipple ,fans,dey dance,dey vibe,dey jolly to my songs,body go dey sweety me,my head go dey swell up,na baba God do am,no be by strength ,no be by gragra garagara.
I go do my best for dis world wey baba give me,i go live dis life,enjoy am wella,vibe am wella like tommorow no dey,i dey unstoppable,unshakable,unmoveable,i dey gallant ,no live ,no transfer.
We go rock dis songs,we go jig am,dig am,pimp am untill every sweat dry,come sweat again and legs come dey heavy to move.
No time,flex life,share the gift wey baba God give you,if you hide am,he go die away,the world no go sabi your name,even devil go flog you like a tiff for the waste of gift.
Baba God as you take lift up my hand above my enemies,carry wings give me so dat i fit fly away anytime wey dey wan do evil to me,carry strength join am so dat i fit fight,flog my enemies like frog wey dey jump inside fog weda.
We go rock dis songs,we go jig am,dig am,pimp am untill every sweat dry,come sweat again and legs come dey heavy to move.
baba God you too much,no baba like you,na only be baba na still you be my God wey dey watch over me ,dey fight my fight,dey war my war,jolly my jolly,baba you too much