A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Tiff no dey tiff tiff
Na shout make tiff run pass him house,tiff no dey tiff tiff na why armed robber na upgrade,ashawo na pro max.
Hunter wey dey hunt goats na tiff,neighbour wey put water for fire,come dey pursue another neighbour fowl na suspect,man wey dey sell goat for night na armed robber,woman wey dey stand for cona for night ,dey fine man na ashawo.
Na shout make tiff run pass him house,tiff no dey tiff tiff na why armed robber na upgrade,ashawo na pro max.
Man wey dey pursue pesin wey no do am enitin na enemy,pesin wey naked enta market na mad pesin,
Na small,small craze dey start,dem go tink say na meditation and overtinking.
Na shout make tiff run pass him house,tiff no dey tiff tiff na why armed robber na upgrade,ashawo na pro max.
You wey dey buy fridge, fridge wey dey cheap,him suppose shock you normally.pesin wey bloc baba God blessing go die of suffocation,dat one na neck chocking.
Tiff,armed robber and ashawo na the same mama born dem,only say one dey carry cutlass,the second dey carry gun dey operate,why the last born,dey use open eyes dey operate.
Na shout make tiff run pass him house,tiff no dey tiff tiff na why armed robber na upgrade,ashawo na pro max.
You dey fly , you dey fly baba avoid high tension,dem no dey tell pesin wey dey fine pikin may hin wear pant go sleep,who know when angel wan enta house.
The war wey mouth fight,if leg reach there, him fit no come back,the pesin wey talk say smoke dey give inspiration neva smoke fire before,crocoach dey over dance ,dey do breaking dance because fowl no dey house.
Na shout make tiff run pass him house,tiff no dey tiff tiff na why armed robber na upgrade,ashawo na pro max.
Neighbour wey dey pursue enemies everywhere don pursue him helper tey ,tey,fasting and prayers don show am signs,water spirits activities don show am wonders.
Na shout make tiff run pass him house,tiff no dey tiff tiff na why armed robber na upgrade,ashawo na pro max.
I no wan fight,i no wan fight na why monk go live for forest.pesin wey dem wan roast chop,no dey carry palm oil rub for body.he no concern me na why dem use fowl for sacrifice.
Na if dem no pursue you,you dey pursue pesin na why dem dey enta white garment church.no be clear eyes man take carry ten toes dey waka under the sun.
Na shout make tiff run pass him house,tiff no dey tiff tiff na why armed robber na upgrade,ashawo na pro max.
The man wey catch tiff for night come use basket cover am na him no wetin catch.dem no dey use ordinary hand dey pursue wetin dey bite.i nid male child,i nid male child na why papa born twelve children under minimum wage.
Na shout make tiff run pass him house,tiff no dey tiff tiff na why armed robber na upgrade,ashawo na pro max.