A song made by Obagudu Mary
A song made by Obagudu Mary
Chai... e don do oh
Wetin person go do now?
I don finish service, certificate for hand
But the road ahead no clear, I no understand
Every application, dem go say "we'll get back"
Online hustle no dey pay, my account dey slack
Two of us dey suffer, two dreams dey on hold
We dey encourage each other, but the nights dey cold
Sometimes I feel empty, like say nobody see me
Stuck for one place, the world just dey leave me
But we go make am, I swear we go make am
This phase no fit last forever, we go shake am
He dey hustle too, same story different day
We dey text each other, "babe e go dey okay"
But who go comfort us when the fear dey choke?
When your mates dey post wins and you dey broke?
Mama dey ask questions, "so wetin you dey do?"
How I go explain say I dey try, I dey pursue?
Sometimes I feel empty, like say nobody see me
Stuck for one place, the world just dey leave me
But we go make am, I swear we go make am
This phase no fit last forever, we go shake am
For now, we just hold each other
Tomorrow go better, we go discover
Our time dey come... abi?