A song made by PRINCE RÖYÁLTY👑🫅🏼
A song made by PRINCE RÖYÁLTY👑🫅🏼
Hallelujah!
The Mighty One dey fight!
My God no be gentleman oh
E dey fight like commando
Every wall wey stand for my front
E go scatter am like Jericho
Protocol dem, E destroy finish
No permission, E just deliver
When demon see am, dem dey shiver
My God na warrior, lion liver
Commando God, You fight for me
Every battle, na victory
Like Jericho, the walls don fall
Evidence dey everywhere
Commando God, You fight for me
Every protocol, You don destroy
Like Jericho, I don cross over
The evidence dey clear oh!
E no dey ask before E move
E no dey wait make I approve
When trouble come surround my life
My God just show like special force
E give me victory upon victory
The proof dey show for my story
From grass to grace, na Him do am
My testimony loud, no be small thing
Commando God, You fight for me
Every battle, na victory
Like Jericho, the walls don fall
Evidence dey everywhere
Commando God, You fight for me
Every protocol, You don destroy
Like Jericho, I don cross over
The evidence dey clear oh!
Glory to God!
The victory is mine!
Hallelujah!