A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
I no be street
I no be street boy,i no wan play street,i no wan fly colour ,i no wan flex bottle,i no wan cap bobo juice.
I no wan run,i no wan kpai,
No wan play street,i no wan chill for mortuary,i no wan pose for casket or coffin.i no wan balancia inside cementry before my time.
Free me,na pen and paper i dey carry,no be matchet i dey carry.i don old to run street.i don chop life,i dey fear spoon wey dem put for my eyes,oga na threat be that.
Na pikin wey dey street,wey never see life na him be thug,you fit still call ajegbako,the one wey don chop life,na ajebo ,i love life, me i wan live,i no wan run for street,i no wan chill for mortuary,i no wan pose for casket ,come balancia for cementry.
I no dey challenge anybody,i no dey buga for your buka,mama ruka know me as Chuka brother.
Abeg free me,abeg free my life,dey your lane,make i maintain mine jejely.but if you wan worry me,na holy ghost buzuka i go take fire you.
I no wan play for sand,i no run naked under rain,i no wan play kpakpa ngolo.I don become peoples papa.
No threaten my life,i no dey play witch witch tins,i no follow you chill for baba pot wey dey boil,i don grow pass that kain play.
I no dey challenge anybody,i no dey buga for your buka,mama ruka know me as Chuka brother.
I wan chill for mortuary,i no wan pose for coffin,i no wan balancia for cementry.free my life,i be free agent,i no dey fly colour,i no dey play bottles, na God and bible i hold strong for this life.
People wey play street yesterday don kpai,people wey fly colour yesterday don roti for ground ,people wey flex bottles don frozen chicken pose for mortuary.
Life dey sweet me,as he dey sweeten your children,
You wey dey recruit boys for street dey inside bullet proof jeep,but your boys dey play body body,ode eshin things,i pity this ones,because dem no ask questions.Men don fall,men don kpai for this street wey you see so.
I no wan kpai leave beta life,i no wan leave beta yash,i no wan kpai leave better ogogoro and cigar.
Bad pikin no near me,bad man fly away,bad friend stay far away,carry your witch witch spoon,thins on thin go faraway from me.
My pen and paper,God wey i get,dey enough for me.Baba God don bless me,he go still bless me,yafu yafu ,yafu.I no want devil's gift ,devil's gift fly away,i be light pikin,i hate darkness.
I no wan run,i no wan kpai,
No wan play street,i no wan chill for mortuary,i no wan pose for casket or coffin.i no wan balancia inside cementry before my time.
Bad pikin no near me,bad man fly away,bad friend stay far away,carry your witch witch spoon,thins on thin go faraway from me.
Life dey sweet me,as he dey sweeten your children,
You wey dey recruit boys for street dey inside bullet proof jeep,but your boys dey play body body,ode eshin things,pity this ones,because dem no ask questions.Men don fall,men don kpai.