A song made by Octavia Anayo 💖💗❤️🔥
A song made by Octavia Anayo 💖💗❤️🔥
Small girl
Tomboy Sopuluchukwu
Na true talk I wan yarn
Sopulu Chukwu, you know say na you
The way you dey make my heart dey do
Tomboy, that's wetin dem dey call you
But for my eye, you be the finest view
I fit yarn am straight, no cap at all
The way I feel, e don reach install
But timing sha, e never align
I no ready yet, but you dey shine
Tomboy, you dey my heart forever oh
Ife'm, even though we never dey together oh
I just want u to know say, nah u be my joy giver
No be say I no love you well well
But right now, my head never settle
My sweet Anastasia, you go dey my heart forever
Sopulu, omo you be my treasure
One day when the time go right
Maybe we go see the light
See, e pain me say I no fit yarn "be mine"
But I no wan start wetin I no go finish fine
I dey fear make e no be say nah wrong thing I wan do
You deserve person wey go show up correct
Person wey go luv u the way u want.
Not me wey never ready to connect
But Sopulu, abeg understand
You dey special, you be part of my life
And I say I luv u so much.
Maybe morrow, maybe next year
But for now, just know say you dey inside my heart
Anastasia, you dey my heart forever oh
Ife'm, obim even though we never together oh
No be say I no love you well well
But right now, my head never settle
Tomboy, you go dey my heart forever
Sopulu, omo you be my treasure
One day when the time go right
Maybe we go see the light
Chukwu knows...
Tomboy, you dey my heart
Forever and ever
Omalicha nnwa