A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Oga go marry
Oga Ifeco go marry,all your mate don get five children wey don enta secondary.Everyday na so so carry carry,today na yellow papaw,tommorow na walnut black,na so so carry carry.
If you sabi drive rough,fast and furious,abeg wear your helmet and kneel guard life no dey two,na one life.
You never marry but your children don plenty for married men houses,all widows for the area sabi the tatoo wey dey for your seven by five inch drilling bit.
If you sabi drive rough,fast and furious,abeg wear your helmet and kneel guard life no dey two,na one life.
Broda carry carry,you go short girl for morning,carry tall girl for afternoon,come carry yellow girl for night.your room na different agbo full am.bro go marry time no dey.Your room na chemistry lab,your bed na slaughter.
You never marry but your children don plenty for married women houses,all widows for the area sabi the tatoo wey dey for your seven by five inch drilling bit.
If you sabi drive rough,fast and furious,abeg wear your helmet and kneel guard life no dey two,na one life.
If dem say make you go marry ,you go say you dey fine wife,all the ones wey dey fire down every day na wetin ,dem be suya?.Broda you be bad influence to the children for the area.
Your mama bring wife for you chop am,she come run,your sister bring wife for you ,you chop am dey claim she no be wife material.Broda pipe and swipe,everyday na so so fight girl dey fight for your house.
Broda carry carry,you go short girl for morning,carry tall girl for afternoon,come carry yellow girl for night.your room na different agbo full am.bro go marry time no dey.Your room na chemistry lab,your bed na slaughter.
If you sabi drive rough,fast and furious,abeg wear your helmet and kneel guard life no dey two,na one life.
Married women come you go chop,singles you go pipe am,widows come you go wipe am wella ,broda,dis kind life no good oooo.the sound from your room no nice bro,your room na studio?
Broda carry carry,you no dey tire at fifty,dis kind life no go favour you for old age.every girl for the area ,you don chop am,your mouth and car na women magnet ,dem no dey say no.
If you sabi drive rough,fast and furious,abeg wear your helmet and kneel guard life no dey two,na one life.
Broda fine boy,wrinkle don dey show for your face,na now you go carry innocent girl wan marry.After one year of marriage no pikin to show.
So so fasting and assignment she dey do,na so she dey run from church to church dey fine pikin.Broda don fire wetin no nice,now old age don come, bullet don finish for broda gun.
If you sabi drive rough,fast and furious,abeg wear your helmet and kneel guard life no dey two,na one life.
Bro Ifeco,last last he be like say na other pipple bullet go fire your antelop at last,this girl don pay for your sinns tire.
Broda fine boy ,marry wen your mate dey marry,go school ,if your head no carry am,if your head carry studies ,go learn skill or business.Time no dey wait for fine boy,age no dey wait for carry carry.
If you sabi drive rough,fast and furious,abeg wear your helmet and kneel guard life no dey two,na one life.
Age no dey pity men wey no get sense,time no dey wait for their waist pain.Age and time dey punish there past like ex convict.Broda carry carry,sickness go torture your past and your present if you no use your head.
If you sabi drive rough,fast and furious,abeg wear your helmet and kneel guard life no dey two,na one life.
Broda carry carry,you go short girl for morning,carry tall girl for afternoon,come carry yellow girl for night.your room na different agbo full am.bro go marry time no dey.Your room na chemistry lab,your bed na slaughter.
If you sabi drive rough,fast and furious ,beg wear helmet and knee guard.Slippery ground dey,slop ground dey,high ground dey,if you fall,you fit kpai,you fit get beta injury wey go dash you wheel chair join.Use your head,time no dey .