A song made by Lolly Dee
A song made by Lolly Dee
Hallelujah
Thank you Jesus for covering me
I thought you were the one wey God send
For church you dey front, dey serve till the end
Your mouth full of scripture, your hands lifted high
But your heart far from Jesus, you live like a lie
I no see am before, I been blind to the truth
You been wear the mask well, deceiving the youth
But Baba God see wetin I no fit see
E break us apart, e set me free
It was God's protection oh
E cover me with salvation oh
You serve for altar but you no know am
Your religion plenty but your heart is cold
God's protection, thank you Father
You save me from the deceiver oh
Service no be intimacy
Now I don see clearly
You quote the Word but you no live the Word
For social media, your praise so loud
But for secret place, you never dey bow
You been want my heart but your own is dark
You been play the part, the church golden boy
But Father God show me say na all na noise
E wound me small but e heal me well
E use the pain take save me from hell
It was God's protection oh
E cover me with salvation oh
You serve for altar but you no know am
Your religion plenty but your heart is cold
God's protection, thank you Father
You save me from the deceiver oh
Service no be intimacy
Now I don see clearly
Glory to God
E dey protect im own
Hallelujah
Thank you Jesus