A song made by ~ṖŔĪMƐ MĪИĪSŦƐŔ 😇
A song made by ~ṖŔĪMƐ MĪИĪSŦƐŔ 😇
Abi na only me dey feel this thing?
Hah!
Lectures in the morning, assignments pile high
But I dey think of someone wey I never even try
See me for library, my mind dey somewhere else
Books dey open but my heart dey on the shelf
Group chat dey blow, but na your name I wan see
Exam next week but you dey stress me
My GPA fighting with these butterflies
Wetin person go do when love never even rise?
I dey read, I dey dream, I dey confuse
School dey call, my heart dey choose
Love never start but e don catch me oh
Books and butterflies, which one I go follow?
E choke!
My roommate dey laugh, say "broda focus!"
But how I go focus when this feeling no be joke sis
Assignment deadline but I dey rehearse what to say
Practice my intro for that day wey go come one day
Balancing equation but my heart no balanced
Dreaming of moments that never even happened
Professor dey talk, I dey nod like I sabi
But my mind dey with someone wey never even rate me
I dey read, I dey dream, I dey confuse
School dey call, my heart dey choose
Love never start but e don catch me oh
Books and butterflies, which one I go follow?
Omo!
Maybe one day e go make sense sha
For now, make I just face my books... abi?
No cap!