A song made by Olaniyi Fadugba
A song made by Olaniyi Fadugba
Everyday na hustle oh
Hah! We dey try, we dey try
NEPA take light again, generator don spoil
Fuel price don hit the roof, my pocket dey boil
One dollar to one thousand, wetin we go do?
Broda say e wan comot, but where e wan go?
Suya wey be hundred naira don turn two-fifty
Even pure water sef, the price no dey friendly
For queue for petrol station from morning till night
Naija my country, this thing no dey right
But we go survive oh, we go survive
No matter the wahala, we must stay alive
We go survive oh, we go survive
Naija we too strong, our hope never die
E choke! We go survive
Youth dey find better life, but job no dey ground
School fees don increase, parents dey breakdown
Transport fare don triple, salary still the same
Government dey chop money, citizens dey blame
But we no go give up, we na Nigerian breed
From Lagos to Abuja, from Kano to PH
We don see worse than this, we still dey stand tall
Ko si wahala too much wey go make us fall
We go survive oh, we go survive
No matter the wahala, we must stay alive
We go survive oh, we go survive
Naija we too strong, our hope never die
Wahala! We go survive
Mo gbe! We still dey here oh
Naija for life
We go survive, abi?
On God!