A song made by Gideon Ochefu Wonders
A song made by Gideon Ochefu Wonders
My broda, my sista
Listen to me
My broda my sista
I dey see the wahala wey dey your mind
The load e heavy for your shoulder
You dey feel say nobody fit understand
But I beg you, make you hear me
No matter the matter
No matter wetin you dey face
Don't choose death as the final option
Your end is not now oh
Just know say there is God
Who dey watch you every day
He dey always ready to hear you
When you call His name
My broda my sista
Your end is not now
God never leave you
Your end is not now
I know say the night e long
And the pain e dey cut deep
But wetin you see today
E no be how e go be tomorrow
God dey see your tears
He dey count every one
And He dey prepare better things
For you my dear
Just know say there is God
Who dey watch you every day
He dey always ready to hear you
When you call His name
My broda my sista
Your end is not now
God never leave you
Your end is not now
Hallelujah
Your end is not now
Praise God
He dey for you