A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
King of the street
Every house get landlord and landlady,street get kings and queens ,if you no ask,you go see,you pay wetin no sweet.
watch your step,no go stray,no go loose guard ,no go tresspas,you go collect wetin no sweet.nobodi send your papa.
Every ganza get king,every corner get lord wey him dey rule the territories,nothing goes without there hand upon your staff .
If your hand no sound well,no put body ,if your head no strong no tresspass,if you check am,you see am ,you go confirm men mount with stainless wey no dey stain but him dey see blood steady.
watch your step,no go stray,no go loose guard ,no go tresspas,you go collect wetin no sweet.nobodi send your papa.
Street game no be for fear fear,no be for no know say surugede na dance of the gods,no be child's play,no be bottle game na stainless go yarn wetin the gods dey yarn.
Street na for pikin wey no dey ear word ,street na for the pesin wey book no gree enta him head.street no dey preach love ,no lover boy for ganza,nothin goes love,love gan sef fit collect.
watch your step,no go stray,no go loose guard ,no go tresspas,you go collect wetin no sweet.nobodi send your papa.
Street king fit lose him throne if him no pay loyalty to another higher king .king fit kpai,smalli fit kpai king wey loose guard,area rebel fit kpai king or pursue am comot for ganza.
watch your step,no go stray,no go loose guard ,no go tresspas,you go collect wetin no sweet.nobodi send your papa.
Na pesin wey see devil sabi the grave wey demons dey stay,street no be place for angels.Wrong capping na wahala,wrong I D na casala,no dulling,dont play.
No go buy market wey you no price ,respect your lane,but no back out if dem price you.street na for witch witch men dem wey don tight up body like iron.
watch your step,no go stray,no go loose guard ,no go tresspas,you go collect wetin no sweet.nobodi send your papa.
Prison na foreign trip for street,olopa cell na five star hotel,if you never go ,you never blend street with your I D.
Street no be for daddy' s boy,no be for church boy ,na for the rejected soul ,never do well.Na few see old age,thug no dey old,if dem no kpai you,you go kpai somebodi ,you fit go foreign trip wey no get end.
watch your step,no go stray,no go loose guard ,no go tresspas,you go collect wetin no sweet.nobodi send your papa.