A song made by De'real Hotshot
A song made by De'real Hotshot
E choke! E choke!
Make una listen oh
Pretty Things dey speak
Abi you no dey hear?
You fine, so wetin? Abeg tell me wetin
Beauty no be achievement, na ordinary skin
Make dem give you front seat just because your face dey correct
But when wahala come, your pretty no go protect
You dey form slay queen, Instagram your second home
But remove the filter, na ordinary bone
Dem go hype you, dem go gas you, call you baddest for the gram
But the real ones wey dey grind, na dem truly understand
Pretty things, pretty things
Na wetin e dey do for you?
Pretty things, pretty things
When the money no dey flow through
You fit fine die, but sense no follow
Beauty na temporary, tomorrow na sorrow
Pretty things, pretty things
Make you wake up oh!
See eh, I no dey hate your face oh
But make your brain get space oh
You think say beauty go carry you go where?
When the wrinkles come, who go dey there?
Dem go open door because you fine
But na your mind go make you shine
You dey depend on man to chop
Sista, your own hand fit reach the top
No let them package you like product for shelf
Your power na inside, go discover yourself
Pretty things, pretty things
Na wetin e dey do for you?
Pretty things, pretty things
When the money no dey flow through
You fit fine die, but sense no follow
Beauty na temporary, tomorrow na sorrow
Pretty things, pretty things
Make you wake up oh!
Omo see this one!
Beauty na bonus, no be the whole package
Go carry your sense join
E choke for real oh
Pretty Things don talk am finish!