A song made by Chikodi Ukaiwe
A song made by Chikodi Ukaiwe
Omo! E choke!
Amala time!
For abula joint, I dey shine
Ewedu and gbegiri, mix am fine
Ponmo plus ogufe, the combo dey sweet
Every Lagos man know say amala no fit beat
From Oshodi to Surulere street
The aroma go make your belle dey greet
Mama put dey serve am hot hot
Two wraps no go do, make e plenty for pot
Amala! Amala! The king of all swallow
Amala! Amala! from today till tomorrow
E go ginger you, e go pepper you
Amala nation, wahala!
Amala! Amala! no competition at all
Amala! Amala! make your spirit stand tall
If you know you sabi, raise your hand oh!
Amala gang, e choke!
Some dey talk about eba and fufu
But amala sweet pass, I no fit lie to you
The color brown like chocolate cake
One taste go make your body shake
Add plenty meat, add assorted
E don do! Person pikin donorted
After work, I dey rush go chop
Amala gang, we no dey stop
Amala! Amala! the king of all swallow
Amala! Amala! from today till tomorrow
E go ginger you, e go pepper you
Amala nation, wahala!
Amala! Amala! no competition at all
Amala! Amala! make your spirit stand tall
If you know you sabi, raise your hand oh!
Amala gang, e choke!
See this one oh!
Amala for life!
Mo gbe!