A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Me self
I be me,you be you,why you come dey vex for me,when i no do you anything.i dey live my life,dey focus on my things,dey run my life like solid solo keke wey no kill anybody for ketu.
I dey feel me,i no dey see your face,before,you be my paddi,i be your guy.
If i smile, you go frown,if you smile,i wan smile too.
My hustle dey vex you,my money dey run your belle.
When i being dey poor,you like me wella wella,now wey baba don put smile for my pocket,you come dey frow face,dey waka like tom wey dey vex for Jerry.
If i offend you ,throw way the past dirty,if you offend me, i don trash am,cast am ,come bind am put for hell.
You be my paddi,i be your guy tay tay,me and you na brothers.if i offend you forgive me,me i don throw way the past wrongs.
If dem talk say ,i talk say ,no mind them ,if dem tell me say ,you talk say ,i go fight dem,tear dem,bite dem like rotweiler.
But if na my blessing dey worry you,i no be God,na baba God wipe my tears with smile and come put money for my pocket ,no be me do am.
My paddi,knee down and pray to baba God ,tommorow if be your turn and i go follow celebrate ,jubilate ,jirate.
If baba hear your prayers ,no go carry carry big big yansh ,come dey drink , dey fall for gutters ,come dey do juju join am,instead ,plan your life ,build house ,marry wife ,help your family members,take care of your parents,then help yourself wela wella.
Me self
I be me,you be you,why you come dey vex me,when i no do you anything.i dey live my life,dey focus on my things,dey run my life like solid solo keke wey no kill anybody for ketu.
My paddi ,na advice i dey yarn no be curse,if you see am as curse,i no dey see you,i no dey look your face.
Na money i dey face,i dey look now,na hustle be my sidechick,na work be my bottle and jolliment.
I dey feel me,i no dey see your face,before.you be my paddi,i be your guy.
If i smile you go frown,if you smile,i wan smile too.
If na My hustle dey vex you,my money dey run your belle. I no dey see your face.
When i being poor,you like me wella wella,now wey baba don put smile for pocket,you come dey frow face,dey waka like tom wey dey vex for Jerry.
If i offend you ,throw way the dirty,if you offend me i don trash am,cast am ,come bind am put for hell.
You be my paddi,i be your guy tay tay,me and you na brothers.if i offend you, forgive me,me i don throw way the past wrongs tay tay.
If dem talk say ,i talk say ,no mind them ,if dem tell me say ,you talk say ,i go fight dem,tear dem,bite dem like rotweiler dog.
But if na my blessing dey worry you,i no be God,na baba God wipe my tears with smile come put money for my pocket ,no be me do am.