A song made by simontiza
A song made by simontiza
Aye! Jostum Library students!
E don do oh!
Make una listen!
For Library and Information Science
Where we dey read book with patience
But exam hall be different experience
Elders dey watch us like CCTV evidence
Simon Tizzy dey patrol like soldier
Assignment dey mark like border controller
Victor the course rep, you know the matter
But invigilation dey scatter our brain scatter!
Comr Ikya Dominic, abeg sir!
Comr Mson Samuel, we carry God beg you oh!
Comr Nathaniel, have mercy!
Comr Tiza Simon, College of Education DOS
We dey try our best, we no dey cheat
Make una ease up, let us breathe!
We carry God the beg una oh!
Jostum Library students, make una hear!
Every five minutes, somebody dey stand beside you
You go think say exam na interview
We know the rules, we no be new
But this over-invigilation dey make person blue
Victor dey try, e dey talk for us
But elders dey serious like is a must
We just wan read, we just wan pass
We no come here to cause any fuss, omo!
Comr Ikya Dominic, abeg sir!
Comr Mson Samuel, we carry God beg you oh!
Comr Nathaniel, have mercy!
Comr Tiza Simon, College of Education DOS
We dey try our best, we no dey cheat
Make una ease up, let us breathe!
We carry God the beg una oh!
Jostum Library students, make una hear!
We carry God the beg una!
E don do!
Jostum Library, we go survive!
Aye!