A song made by Kamshel
A song made by Kamshel
My love, my queen
Five years don pass oh
E choke!
From day one wey I see you
I sabi say na you be the one
Mother of my pikin dem
You don show me wetin be real love
Sometimes my jealousy dey cause wahala
Misunderstanding dey come, I no go lie
But na because I love you pass anything
I fit lose my mind if I loss you
Five years we don dey together
Through the storm and the sunshine
I promise you baby I go stay forever
No distance fit separate our love this time
Five years and I never tire
You be my heartbeat, my desire
Now you dey Jos for your final exam
This one na new beginning for us
I dey pray make you succeed
So we fit build our future with trust
After all the struggle wey we don face
I wan kneel down put ring for your hand
Make you become my wife officially
So the whole world go understand
Five years we don dey together
Through the storm and the sunshine
I promise you baby I go stay forever
No distance fit separate our love this time
Five years and I never tire
You be my heartbeat, my desire
Mrs. to be
My forever queen
I love you die!