A song made by EM.LEGEND
A song made by EM.LEGEND
Ahh I see you OH!
Holy Ori Marry
Debbie, baby e don do
Debbie you miss your test for my sake low
I be human, I dey make mistake sorry so
If I offend you, abeg make you no vex oh Ori
Throw first stone only if your heart holy
I no be lover boy, but see you for my dream only
Ajike, still dey love you baby
You be my only future, Holy marry
Debbie, Emmy, everybody get their time OH
Holy Ori lead me, double grace na my story
My life no perfect, some dey happy OH
Some dey depressure, since you left me lonely
Law fit die, but our love go renew holy
Only Debbie fit marry me, Ori
E choke! See wetin love don do me
My heart dey beat like talking drum for body
Debbie baby, no send me away oh
Make we start again, I go change my way oh
Ajike you sabi say na you I want
No be ordinary thing, this one na covenant
Ori witness am, heaven don approve am
Double grace dey wait, make we no lose am
Debbie, Emmy, everybody get their time OH
Holy Ori lead me, double grace na my story
My life no perfect, some dey happy OH
Some dey depressure, since you left me lonely
Law fit die, but our love go renew holy
Only Debbie fit marry me, Ori
Wahala don plenty for this life
But your love dey give me ginger to survive
Debbie baby, abeg no leave me
Our love go renew, Holy Ori marry
Holy Ori Marry
Debbie, na you I choose
Ajike, my heart na you
E choke!