A song made by Victor Nwije
A song made by Victor Nwije
E don tey wey we dey wait oh!
Make God answer!
Every day na the same question
When man go rest from this oppression
No be say we no dey try oh
But the system e just dey lie oh
From Monday straight to Sunday
Wahala no dey give holiday
We dey hustle, we dey grind oh
But freedom never show for mind oh
When will man be free? (When!)
To dey live the life wey e suppose be (Omo!)
When will man be free? (Abeg!)
From all this wahala and the agony (Chai!)
When will man be free?
Somebody tell me when e go be
When will man be free?
On God we dey wait patiently
They say make we dey patient
But person pikin don tire for this basement
Landlord dey knock, NEPA dey vex
Fuel price don reach the apex
Still we no go give up sha
One day man go chop better jara
Freedom go sweet like sugar
The day wey we finally comot for this gutter
When will man be free? (E choke!)
To dey live the life wey e suppose be (No cap!)
When will man be free? (Hah!)
From all this wahala and the agony (Person pikin!)
When will man be free?
Somebody tell me when e go be
When will man be free?
Mo gbe if e no happen soon oh!
One day man go free
Abi?
On God!