[male vocals] Baba
Ade
Ade
baba,
de
happy
man,
no
dulling,
na
so
so
jolliment ,
Ade
na
happy
man
wey
get
plenty
wives
and
plenty
children,
na
drink,
for
morning,
drink
for
afternoon,
na
plenty
drink
for
night,
hangover
na
blessing
from
the
bottles.
Baba
Ade
go
yarn
say,
life
na
jolli,
life
na
jeje,
asiko
laye ,
asiko
mi
niyi.
life
is
a
season,
this
is
my
season,
let
me
enjoy
and
live
my
life
to
the
brim.
Monday
to
Friday
na
fight
and
wahala,
all
him
wives
na
street
fighters,
dem
go
fight
so
tay,
dem
go
quarrel
demselves
so
tay,
dem
go
tear
cloths,
dem
go
curse
demselves,
na
so
all
the
pikin
go
dey
fight,
dey
curse,
dey
quarrel
demselves.
Dem
no
dey
tire.
Baba
Ade
na
magistrate
Judge,
na
so
him
go
dey
judge,
dey
settle
quarrel,
Ade
na
popular
man
wey
everybody
sabi.
quarrel
no
dey
tire
him
pipple,
fight
na
morning
mass,
na
de
blessing
de
wahala
dey
carry
dem
enta
evening
jolliment,
him
go
come
be
like
say
dem
neva
quarrel
before.
Baba
Ade
go
yarn
say,
life
na
jolli,
life
na
jeje,
asiko
laye ,
asiko
mi
niyi.
life
is
a
season,
this
is
my
season,
let
me
enjoy
and
live
my
life
to
the
brim.
Ade
baba
na
happy
man,
him
no
dey
tire,
mama
Iyabo
turn
for
morning,
Iya
Tunde
turn
for
afternoon,
Mama
turn
Emeka
for
night.
Jolliment
be
like
ant
wey
fall
enta
inside
sugar.
Na
so
Ade
baba
dey
jolli
dey
go
no
dull
moment
at
all.
Pikin
plenty
full
everywhere,
cultist
dey,
armed
robba
dey,
tiff
dey,
pastor
dey,
lawyer
dey,
native
doctor
dey,
taxi
driver,
agbero
dey,
beta
doctor
dey,
police
dey,
soldier
dey,
yahoo
boy
dey,
comedian
dey.
If
you
go
fine
trouble
for
Baba
Ade
house,
you
don
enta
one
chance,
your
body
go
tell
you,
nobody
go
tell
you.
Ade
baba
na
happy
man
wey
no
get
time
for
long
yarn,
just
give
am
bottles
and
ciga,
life
don
beta
be
dat,
no
wahala,
no
quarrel,
na
so
so
laugh
and
yarn
una
go
dey
yarn
till
day
go
break.
Baba
Ade
go
yarn
say,
life
na
jolli,
life
na
jeje,
asiko
laye ,
asiko
mi
niyi.
life
is
a
season,
this
is
my
season,
let
me
enjoy
and
live
my
life
to
the
brim.
Ade
baba
house
na
barrack
wey
mad
pipple
full
am,
no
go
find
trouble
for
there,
na
so
your
mama
go
tell
you.
na
war
you
go
fight ,
no
be
quarrel,
everybodi
go
run
leave
you,
dem
no
dey
fear,
dem
no
dey
run,
dem
be
soldier
ants,
dem
plenty
no
be
small,
dem
plenty
wey
dey
mad
too.
All
de
pikin,
boys
and
girls
no
send
your
mama,
dem
go
razz
your
area,
you
no
go
talk,
dem
be
crazy
pipple,
but
baba
Ade
na
happy
man
wey
dey
happy,
de
jolli
life
like
ant
wey
dey
inside
sugar.
Na
so
so
drink
and
cigar
jolliment.
Wives
plenty,
children
plenty,
side
chicks
full
every
conar ,
na
so
dem
born
full
everywhere
like
barrack
rats.
Baba
Ade
na
Brigadia
commanda
wey
no
be
soldier
but
him
get
batallion
of
sojars
and
mad
pipple
wey
dey
worry
community.
Baba
Ade
go
yarn
say,
life
na
jolli,
life
na
jeje,
asiko
laye ,
asiko
mi
niyi.
life
is
a
season,
this
is
my
season,
let
me
enjoy
and
live
my
life
to
the
brim.
Ade
baba
na
taxi
driver
wey
drive
women
pass
wetin
dem
no
know.
For
dis
baba
Ade
life
everyday
na
owanbe,
jolliment ,
fleximent,
he
no
send
your
face,
na
chop,
drink
and
dance
till
dawn,
come
born
pikin
full
everywhere.
Ade
baba
no
come
dis
life
to
come
suffa,
na
to
jolli,
flex,
born
pikin
full
everywhere,
drink,
dance
till
dawn
na
him
grace
be
dat,
no
go
copy,
follow
baba
Ade,
you
no
go
fit
survive
am.
Baba
Ade
go
yarn
say,
life
na
jolli,
life
na
jeje,
asiko
laye ,
asiko
mi
niyi.
life
is
a
season,
this
is
my
season,
let
me
enjoy
and
live
my
life
to
the
brim.