[male vocals] If
baba
God
shine
your
shoes
Na
baba
God
dey
bless
no
be
man,
baba
god
too
much,
i
go
dey
thank
am
everyday,
if
man
bless
you,
he
fit
vex
collect
back.
if
you
shine
too
much,
man
go
vex
close
your
gate
of
blessing.
If
baba
god
don
sign
your
blessing,
nothin
fit
wedge
am,
enitin
wey
fly
untop
na
kpai,
enitin
wey
put
hand
don
follow
wind
go.
If
baba
god
don
shine
your
shoes,
your
your
face
go
show
like
mirror
wey
dey
for
sun.
If
man
blend
you,
he
fit
vex
blank
you
come
plank
you
two
by
two
ontop.
man
fit
help
you
but
him
no
fit
bless
you.
Na
only
baba
God
fit
blend
you
come
bless
you
yafffu
yaffu
pass
wetin
you
fit
imagine.
If
baba
god
don
sign
your
blessing,
nothin
fit
wedge
am,
enitin
wey
fly
untop
na
kpai,
enitin
wey
put
hand
don
follow
wind
go.
If
baba
god
don
shine
your
shoes,
your
your
face
go
show
like
mirror
wey
dey
for
sun.
If
to
say
na
man
dey
give
life,
na
only
him
family
members
him
go
bless
wella
wella.
Man
fit
turn
him
fellow
man
to
slave
if
to
sey
power
of
blessing
dey
for
him
hand.
Man
na
man,
baba
god
too
much.
Even
Bible
yarn
sey,
man
wey
trust
him
fellow
man,
sey
na
curse
him
go
collect.
de
tin
come
be
like
de
pesin
wey
sow
seed
inside
wind
na
nothin
him
go
reap
na.
no
carry
your
mind
put
for
anoda
man
hand.
if
you
try
am,
na
cry
you
go
cry,
you
fit
kpai
join.
If
baba
god
don
sign
your
blessing,
nothin
fit
wedge
am,
enitin
wey
fly
untop
na
kpai,
enitin
wey
put
hand
don
follow
wind
go.
If
baba
god
don
shine
your
shoes,
your
your
face
go
show
like
mirror
wey
dey
for
sun.
Life
wey
anoda
man
give
you
na
small
tinkili
rain
wey
small
breez
go
dry
am
enitime.
na
baba
god
dey
blend
and
bless
no
be
man,
if
na
man
dey
feed
you,
one
day
you
fit
kpai
inside
otapiapia
food.
De
pesin
wey
you
trust
na
him
go
stab
you,
come
kpai
you,
na
friend
and
family
member
wey
dey
inside
house,
dey
open
door
for
enemy
wey
dey
outside
house.
no
go
slack
my
bros,
no
go
dull,
my
alaye
bobi
no
fall
hands,
no
go
sleep
on
tins
my
paddi,
no
go
loose
guard
my
guy,
stay
alert.
If
baba
god
don
sign
your
blessing,
nothin
fit
wedge
am,
enitin
wey
fly
untop
na
kpai,
enitin
wey
put
hand
don
follow
wind
go.
If
baba
god
don
shine
your
shoes,
your
your
face
go
show
like
mirror
wey
dey
for
sun.
If
you
like
block
and
blank
my
ways,
ways
too
plenty
for
pesin
wey
baba
god
don
bless,
if
you
stand
for
him
way,
flood
go
carry
you,
if
you
put
hand,
wind
go
collect
your
hand,
if
you
put
body
you
go
kpai.
Who
baba
god
don
bless,
he
don
bless
finish
come
blend
am
wit
beta
jolliment,
no
put
body,
make
you
no
end
for
fridge,
no
put
hand
make
you
no
collect
bad
slap.
De
man
wey
wan
block
train,
dey
for
mortuary,
na
vulture
pepper
soup
be
dat.
If
baba
god
don
blend
you,
he
don
bless
you
be
dat,
no
capp,
no
lapp.
If
baba
god
don
sign
your
blessing,
nothin
fit
wedge
am,
enitin
wey
fly
untop
na
kpai,
enitin
wey
put
hand
don
follow
wind
go.
If
baba
god
don
shine
your
shoes,
your
your
face
go
show
like
mirror
wey
dey
for
sun.
De
pesin
wey
dey
haala
river
sey
him
no
fine,
come
stand
for
him
front,
fish
don
chop
am
finish.
no
go
cap
anyhow,
no
go
yarn
wetin
no
nice
for
ganza.
face
front
pledge
your
filth
make
dem
plank
you,
come
forgive
you.
If
na
man
dey
share
blessing
he
for
do
am
paddi
paddi,
guy
guy,
alaye
alaye,
he
for
no
rich
everybodi.
sun
for
no
dey
shine
for
some
pipple
roof,
rain
for
no
dey
fall
ontop
of
some
pipple
roof,
even
crops
for
no
dey
grow
for
some
pipple
farm.
If
baba
god
don
sign
your
blessing,
nothin
fit
wedge
am,
enitin
wey
fly
untop
na
kpai,
enitin
wey
put
hand
don
follow
wind
go.
If
baba
god
don
shine
your
shoes,
your
your
face
go
show
like
mirror
wey
dey
for
sun.