A song made by princess baddie 🌚😈💖
A song made by princess baddie 🌚😈💖
Chai... person pikin
Five years oh
Five years I give you
I dey for you when nobody show
E be like say na only me know
Your worth, your pain, your everything
Now my broda and my babe dey do their thing
Wetin I no do? Abeg tell me true
Make I understand wetin I do you
The love wey pure, you scatter am like glass
Now the pain dey choke me, e no fit pass
Five years oh, five years wasted
Give you my heart, see how you waste it
My best friend sef, join hand betray me
But I go rise, omo you go see
Five years oh, five years wasted
The love wey real, see how you waste it
But thunder no go fire una
I move, I dey okay sha
Na Instagram I see the sign dem
Your phone dey buzz, you dey form say na them
My own broda wey I trust pass all
Now the two of you dey make me look like fool
E pain me well well, I no fit lie
Some nights I just dey look ceiling, I no cry
But morning go come, I go stand again
Your loss oh, not mine, e go pain
Five years oh, five years wasted
Give you my heart, see how you waste it
My best friend sef, join hand betray me
But I go rise, omo you go see
Five years oh, five years wasted
The love wey real, see how you waste it
But I move on, person pikin
My healing don begin
E don do
I don learn my lesson
Person wey wan stay, go stay
Abi?