A song made by David Akinola
A song made by David Akinola
Abi you dey mad?
Make I tell you something oh!
Dem go come with money, dem go come with rice
Dem go promise heaven, but na hell be the price
Your future no be beans, your voice no be for sale
Naija people wake up, make we tell dem the tale
E no matter the party, red or green or blue
If dem no get vision, abeg no let dem fool you
Our papa dem suffer, our mama dem don tire
This generation, we go set this place on fire!
No sell your vote oh! Wahala!
No sell your vote oh! E choke!
Your children go ask you tomorrow
Wetin you do when e matter?
No sell your vote oh! On God!
No sell your vote oh! Person pikin!
Naija no be for sale at all
Make we stand tall!
Two thousand naira no fit change your life
But your vote fit end this country wahala and strife
Check their record, wetin dem don do before?
Words na cheap, but action na the core
Dem go share salt and Maggi, call am empowerment
But after election, na you go dey lament
Your PVC na weapon, use am well well
Make dem know say Naija people no be mumu, we sabi smell!
No sell your vote oh! Omo!
No sell your vote oh! Chai!
Your children go ask you tomorrow
Wetin you do when e matter?
No sell your vote oh! E don do!
No sell your vote oh! Mo gbe!
Naija no be for sale at all
Make we stand tall!
E choke for dem oh!
Naija, we rise!
No sell am oh!