A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Oga solo
Oga solo wey dey live for Isolo wey no wan slow
down for baba God go get wahala wey get agbakara for chest.
I dey fear,who no dey fear God,oga solo,no mind dem,this life go teach you beta lesson,bad people go pursue you enta beta place.
Oga solo if you dey help the poor people use your head,some of dem go talk say you dey use there destiny.Hahahaha,hahahaha poor man destiny wey no get destination na destitution wey come resenble prostitution.
Help dem problem,you no help dem problem,dem chop your food,still open there mouth dey spoil your name,small time,dem go come dey beg you for food and money.
The tori be say,if baba god bless your bank account,and you come balancia wella,help who need help ,na baba god go judge dem for you.
Oga solo wey dey live for isolo wey no wan slow
down for baba God ,go get wahala wey get agbakara for chest.
The destitute wey him destiny don destroy like spoil spoil milk na him dey talk bad pass,na still him dey beg pass.
Baba God bless who dey love me for my back ,dey praise me for my front,judge the wan wey dey spoil my name for my back but dey praise me for my front.
The tori be say,if baba god bless your bank account,and you come balancia wella,help who need help ,na baba god go judge dem for you.
The destitute wey him destiny don destroy like spoil spoil milk na him dey talk bad pass,na still him dey beg pass.
Na bless baba god bless me,no be crime to love baba God wella wella,na so him come love me too.
Watch over me,fight for me,dont allow evil to override good people,give good people wisdom to walk through thorns and traps of evil people.
I no dey fear,i no dey shake,i gallant wella,come carry beta faith in God join am,plan your evil,he no go work,gang up,he go fail,waka for night up and down , nepa go bring light,everybody go see your face.
Watch over me,fight for me,dont allow evil to override good people,give good people wisdom to walk through thorns and traps of evil people.
I dey fear,who no dey fear God,oga solo,no mind dem,this life go teach you beta lesson,bad people go pursue you enta beta place.
Baba God bless who dey love me for my back ,dey praise me for my front,judge the wan wey dey spoil my name for my back but dey praise me for my front.
Oga solo if you dey help the poor people use your head,some of dem go talk say you dey use there destiny.Hahahaha,hahahaha poor man destiny wey no get destination na destitution wey come resenble prostitution.
I no dey fear,i no dey shake,i gallant wella,come carry beta faith in God join am,plan your evil,he no go work,gang up,he go fail,waka for night up and down nepa go bring light,everybody go see your face.