A song made by Gracefilled E Music
A song made by Gracefilled E Music
Hallelujah!
Thank you Jesus!
Every morning wey I wake
Na your mercy dey cover me
Wetin I do to deserve your love?
Lord you too good, e dey sweet me
From my head down to my toe
Your blessings dey overflow
I no fit count am, e too plenty
Lord am grateful, am grateful
Lord am grateful for your love oh
Lord am grateful for your grace
You carry me when I weak
You dey guide me every day
Lord am grateful, am grateful
Lord am grateful, hallelujah!
Lord am grateful for your love oh
Jesus am grateful
When wahala wan surround me
You be my shield and my defender
When people say e no go work
You turn my story to wonder
Chukwu, you dey for me
Baba God, you no dey sleep
Your love na the real thing
Lord am grateful, forever grateful
Lord am grateful for your love oh
Lord am grateful for your grace
You carry me when I weak
You dey guide me every day
Lord am grateful, am grateful
Lord am grateful, hallelujah!
Lord am grateful for your love oh
Jesus am grateful
Thank you Jesus!
Amen!
Glory!