A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
(Piano playing softly)
I wish fit turn am
I wish fit turn time,i wan run under rain like pikin,i wan play with my friends running around naked under the rain,i wan enjoy dat innocence wey dey our life.
I wan run,i wan fight,i laugh,i wan play,i wan run,i wan chop,i wan build,i wan play actor,you wan play boss,i wan cry,i wan make dem pet me,i wan throw stones,chase lizard,i wan trek go different places.i wan play game,i wan lick sugar,chop dry garri wit straw.
I wish i fit twist the hand of time,i wan build sand castles,creating my own private tunnels and underground trains.I wan rant come tell my friend about my latest ideas.
I wan run,i wan fight,i laugh,i wan play,i wan run,i wan chop,i wan build,i wan play actor,you wan play boss,i wan cry,i wan make dem pet me,i wan throw stones,chase lizard,i wan trek go different places.i wan play game,i wan lick sugar,chop dry garri wit straw.
I wish could rewind the hand of time,i wan build bamboo cars,with flip-flop cut-out through with hot iron tiger touch light.
I wan run,i wan fight,i laugh,i wan play,i wan run,i wan chop,i wan build,i wan play actor,you wan play boss,i wan cry,i wan make dem pet me,i wan throw stones,chase lizard,i wan trek go different places.i wan play game,i wan lick sugar,chop dry garri wit straw.
How i wish i can turn hand of time,i wan play counter game,rubber game and cashew game with my friends.Ready to run,once i defeat them or fight to protect my winnings.
I wan run,i wan fight,i laugh,i wan play,i wan run,i wan chop,i wan build,i wan play actor,you wan play boss,i wan cry,i wan make dem pet me,i wan throw stones,chase lizard,i wan trek go different places.i wan play game,i wan lick sugar,chop dry garri wit straw.
How wish i could turn hand of time,i wan chop my transport fare,then come trek from school to shop under the hot sun ,while serious argument and discussion dey go on.
I wan run,i wan fight,i laugh,i wan play,i wan run,i wan chop,i wan build,i wan play actor,you wan play boss,i wan cry,i wan make dem pet me,i wan throw stones,chase lizard,i wan trek go different places.i wan play game,i wan lick sugar,chop dry garri wit straw.
How i wish i could turn the hand of time,i wan run around the neighbourhood unkept,buying kulikuli and danguwa,drinking ice cream.
How i wish i could turn back the hand of time,i wan my papa to carry me for him shoulders,while i dey smile,dey wave friendly and unfriendly faces also waving at me.
I wish i could turn back the hand of time,i wan return my innocence,i no wan tink about money,bill and debt,i no wan tink about problems and politics wahala.
How i wish i could turn back hand of time,i wan cry ,wail,shout,scream,playrun everywhere,play ball everywhere,fight everywhere and anywhere.
I wish i could turn back the hand of time,i wan drink all mana of sweet beverages without health consequences.