A song made by AMB. GIDEON
A song made by AMB. GIDEON
Ambassador Gideon dey speak
Jagaban, you dey hear?
Naija dey bleed o
Every day na burial, every night na tears
Bandits dey move freely, nobody fit interfere
Christians dey fall like rain for the North
Women dey cry, children dey shout forth
Kidnappers dey collect, ransom dey rise
Masses dey suffer, death dey multiply
Mr. President, wetin you dey do?
Nigeria dey die, we dey look unto you
Jagaban, wake up, Naija dey burn
People dey cry, when e go be our turn?
If you don tire, abeg resign make we see road
No be curse, na plea from the soul
Jagaban, wake up, the people don tire
Mass burial every week, the situation dire
Correct am or comot, make Nigeria breathe
We need freedom, Jagaban, we need relief
Terrorists dey reign, government dey sleep
Mothers dey bury sons, the wound too deep
No security, no hope, no plan
Ambassador Gideon dey talk as a Nigerian
You carry the burden, abi e too heavy?
If you no fit lead, step down, make we see
This no be disrespect, na reality check
Nigeria dey sink, we need you to protect
Jagaban, wake up, Naija dey burn
People dey cry, when e go be our turn?
If you don tire, abeg resign make we see road
No be curse, na plea from the soul
Jagaban, wake up, the people don tire
Mass burial every week, the situation dire
Correct am or comot, make Nigeria breathe
We need freedom, Jagaban, we need relief
Ambassador Gideon don talk
Jagaban, the ball dey your court
Nigeria dey wait