A song made by Smilingjay🙂🚀
A song made by Smilingjay🙂🚀
Mmm... e dey heavy for my mind oh
Chai...
I dey wake up every morning
Same old feeling dey surround me
I dey ask myself questions
Wetin really go make me happy?
I don try many many things
But e be like say nothing fit stick
My mind just dey wander
I no fit find my peace
I no know wetin I want oh
I no know wetin go make me smile
I just dey think and think and think
Searching for something I no fit find
Abeg, somebody help me oh
This wahala too much for me
I just wan know wetin dey make me happy
I just wan feel like myself again
Late night, I dey reason am
Every path I don take before
Nothing really dey satisfy
My heart still dey look for more
Maybe na confusion
Or na just say I never find my way
But I go keep on searching
Until I see brighter day
I no know wetin I want oh
I no know wetin go make me smile
I just dey think and think and think
Searching for something I no fit find
Abeg, somebody help me oh
This wahala too much for me
I just wan know wetin dey make me happy
I just wan feel like myself again
Someday I go find am
Mo gbe...
Someday...