A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Wan dey
One dey life go beta pass today,life go jolly,everybody go jolly too,peace go dey,work go dey plenty,nobodi go judge another pesin base on say him no be human being.
One dey life go totori me and my children for this land wey baba God carry give us,come bless us ontop.
Wan dey nobodi go talk say you no be indigene,so you no go fit work,say you no fit sell for market,say you no fit play football,say you no go fit enta some kind places because you no be community boy or girl.
One dey nobodi go talk say one tribe no go fit become president of a country wey all of us join hands collect am from white man wey dey oppress all of us,dey thiefy thiefy our mineral resources.
One day life go totori,jolly for white,jolly for black and brown come sweet for big man and poor man,life go come beta for children and women everywhere,anywhere.
One day nobodi go fight another pesin unto say na politics.nobody go see ballot box carry,nobody go rigg election unto say the election na online,everybodi dey see am,that dey, na only one hand ,one spoon go enta for the pot of soup.
One dey life go beta pass today,life go jolly,everybody go jolly too,peace go dey,work go dey plenty,nobodi go judge another pesin base on say him no be human being.
One day railway go dey wella,somebodi go fit dey live kano,dey do business for Aba,dey come Aba for morning ,return for evening.one day,One man go come Lagos for morning return for Onitsha for evening.This kind railway go make life beta for the economy and the pipple of the country .
One day electricity light go dey yafuu,yafun for everywhere like mobile phone.Everybodi go dey jolliment,dey totori life like fisherman for tombia wey him name na tobi.
One day no judge go collect bribe from anybodi,him go judge in fairness ,equity and rule of law,poor man wey no get money go get justice,big man wey no get connection go fit get justice.
One day ,terrorists no go dey,bandits no go exist,activists no go get any reason to protest,freedom fighters go dey preach literature and culture
One day all the tribes go love themselves,cow no go chop my cassava and me , i no go fight herders,everybodi go live in unity.
Baba come answer our prayer,bring beta pesin wey go bring beta development,make everybody jolly,make life sweet for the rich and the poor,make jolliment reach the educated and the uneducated.
One day nobodi go fight another pesin unto say na politics.nobody go see ballot box carry,nobody go see election rigg unto say the election na online,everybodi go dey see am,that dey na only one hand ,one spoon,go dey enta one pot of soup.
One day all the tribes go love themselves,cow no go chop my cassava and me i no fight herders,everybodi go live in unity.
One dey life go totori me and my children for this land wey baba God carry give us,come bless us ontop.