A song made by S.J.O
A song made by S.J.O
Yo, broda mi
I need your advice oh
This matter dey heavy for my mind
See as my heart dey beat, omo
Every time she dey smile for me
I don already fall, no cap
But fear wan hold me down
Wetin if she say no?
Wetin if I lose her as my friend?
Abeg, you guys gats tell me true
Shey I fit take this chance?
Should I shoot my shot oh
Or make I just dey look?
E dey fear me, I no go lie
But this love dey choke
Tell me bros, wetin I go do?
My heart say yes, but fear say no
Should I shoot my shot oh
Or make I let am go?
See, I don already buy the ring sef
E dey my drawer, dey shine for me
But every time I wan talk
The words just dey disappear
Mo gbe! This matter no easy
She be the one wey dey make sense
If she say yes, na heaven
But if she say no... chai!
Should I shoot my shot oh
Or make I just dey look?
E dey fear me, I no go lie
But this love dey choke
Tell me bros, wetin I go do?
My heart say yes, but fear say no
Should I shoot my shot oh
Or make I let am go?
I think say... I go try am
No regrets, abi?
Wish me luck, my people
Ah!