A song made by Adekpe Moses
A song made by Adekpe Moses
Omo! Who send me come this PHY 101?
Mr. Gbaruon don show!
Mr. Gbaruon, broda you too sabi
Your brain sharp like razor blade e dey scary
You dey teach us Newton like say na small thing
But exam time, wahala go begin
Question one go scatter person brain
Question two go cause me serious pain
E be like say you get PhD for wahala
Your exam paper no be here oh baba
Gbaruon! Gbaruon! The question killer
E choke! Your brain too sharp we no fit cope
Gbaruon! Gbaruon! Oga professor
Abeg sir! Make the exam easy small na!
Gbaruon the genius, omo e don do!
Your question go wound person sotey e go show
Gbaruon the brain, we hail you sha
But sir abeg, mercy on exam day!
For class you dey explain everything clear
But exam paper go make person fear
Wetin you teach us no be wetin you set
Na advanced level question we go get
Physics wey suppose simple, you go complicate
Student go dey cry, some go dey wait
You too intelligent, e dey show for your face
But sir, our future dey your hand oh, no waste!
Gbaruon! Gbaruon! The question killer
E choke! Your brain too sharp we no fit cope
Gbaruon! Gbaruon! Oga professor
Abeg sir! Make the exam easy small na!
Gbaruon the genius, omo e don do!
Your question go wound person sotey e go show
Gbaruon the brain, we hail you sha
But sir abeg, mercy on exam day!
See this one oh! Mr. Gbaruon we love you sha
But abeg, show us small mercy!
Wahala!