A song made by Paul Shobowale
A song made by Paul Shobowale
Oya, this one na special, no be ordinary jare,
This song is dedicated to olamide Esther idowu, my one and only boss lady at sun king ilesha,osun state
My day one padi, nah she be the full definition of kindness,she nice pass 9ice alapomeji,
E no easy to find person wey get your back like say na mission
Every single day you dey there, no cap, you dey give me vision
When the work dey pepper, you dey give me ginger, you know the remedy
Sista, you na the real MVP, you set the bar steady
From the table meeting things to the field sales and video prospect wahala then,
You are always there with the ginger and the wisdom sha
Na you dey carry me when I wan fall, abi I lie?
You na the kind friend wey money no fit buy
My boss lady, My oga at the top,
You no go fail, you no go fall
You dey shine bright like homeplus max bulb, you get sense like motion sensor
Angel face with the sweetest grace
My iron lady,My support system,
Thank you, thank you, you too much
You make every day better and brighter just like sun king solar systems,
Olamide idowu, My sister, my friend,my helper, you are crystal clear
No competition, you na the real definition of kindness and loyalty
We dey vibe like we speak in code, we no need no formality
You celebrate me like na your own blessing wey come
And when I fumble, you pick me up, say "bro mafo i dey with you, na nothing, even though tongue and teeth dey fight you are still be my number one"
The office never dull when your energy dey around
You keep it real, you keep it light, you keep it profound
May God bless you with all the good things life can give
Because you make this sun king journey sweet for me, that's how you gotta live
My oga at the top, my solid rock
You no go fail, you no go stop
You dey shine bright like you own the place
Angel face with the sweetest grace
My oga at the top, my boss lady
Thank you, thank you, you too much
You make every day better when you are near
My sister, my friend,my boss lady you are crystal clear
E choke, i appreciate all your efforts, may your dreams come true
You na the legend, no dulling
Forever grateful,may God bless you always