A song made by Udehani Chinedu
A song made by Udehani Chinedu
Life no balance
Life no balance na why bandit dey do tick tok ,come dey do give away for soldiers.dem collect your bag for street,come flex am for your compound ,na wetin man do man
Life no balance ,na wetin man do man:
The girl wey i carry go for councelling dey tell me say oga councellor get pink lips,and na fine boy.Goat don chop wey dem give am to keep.Oga councellor don councell wetin no nice.
Dokita don go fall in love with with pesin wife,onto say she carry belle.Wetin oga Dokita supposed use handglove finger na him oga don carry seven inches dey pipe anyhow,na wetin man do man.
Dog don go chop de bone wey dem give am to protect com dey bark bone owner say bone na him birthright.
Pesin wey dem call to come chop don sieze food,com dey form steeze ontop,pesin wey i employ for bakery don dey pursue me say bakery na him own.
Bad pesin na pesin,no mata who him be,no collect wetin no be your own,no put eyes for wetin no concern you,bad belle na him kill cow for slaughta.
Bro gym instructor na god go punish you,na me bring her,na me register her but na you collect am from me.you com train her for gym,come bend her for bed.na god go koboko you.
Life no balance na why witch choose to fly for night like ashawo.life no balance na why pastor get mind dey position pesin wife for doggy.
Life no balance na why ashawo dey tell me say terms and condition apply.Life no balance na why yesterday leader na him still be today youth leader at seventy years.
Bad pesin na pesin,no mata who him be,no collect wetin no be your own,no put eyes for wetin no concern you,bad belle na him kill cow for slaughta.
Life no balance na why gym instructor get mind collect soldier man wife,life no balance na why councellor get mind dey toast girl wey come for marriage councelling.
Life no balance na why witch choose to fly for night like ashawo.life no balance na why pastor get mind dey position pesin wife for doggy.
Life no balance na why,maid collect oga from madam,com still pursue madam from the house.Carry madam pikins dem do maid.life no balance na why police need protection.
Life no balance na why gym instructor get mind collect soldier man wife,life no balance na why councellor dey get mind dey toast girl wey come for marriage councelling.
Life no balance na why bandit dey do tick tok ,come dey do give away for soldiers.