A song made by Simply Tosin
A song made by Simply Tosin
Ayy! E don reach oh!
Make we celebrate!
Today na your day, person pikin
Make we turn up, no be small tin
From morning reach night, we dey celebrate you
Your matter dey sweet, e no get duplicate oh
God don bless you well well, e choke!
Every year you dey shine, no be joke
Make we spray the money, pop the bottle
Happy birthday to you, full throttle!
Happy birthday oh! (Happy birthday!)
Today na your day oh! (Your day!)
Make we celebrate, omo, you too fine
Happy birthday oh, you dey shine! (You dey shine!)
Wahala for who no like you
Today we go party, e go loud!
Happy birthday oh!
You be the baddest, no cap!
See as everybody dey show for you
The love plenty, e dey overflow true
Cake tall, jollof rice dey hot
DJ abeg, give am the best slot
Anoda year, anoda level up
God go continue to fill your cup
No competition, you don win am
Happy birthday, make we begin am!
Happy birthday oh! (Happy birthday!)
Today na your day oh! (Your day!)
Make we celebrate, omo, you too fine
Happy birthday oh, you dey shine! (You dey shine!)
Wahala for who no like you
Today we go party, e go loud!
Happy birthday oh!
You be the baddest, no cap!
E choke! Happy birthday oh!
Make we gbadu! Omo!