A song made by Cyril Peterson
A song made by Cyril Peterson
“Which One Be One Nigeria?”
Verse 1 — The Marginalized Nigeria
For North, pikin dey hawk pure water
For South, mama no fit pay doctor
Graduate dey ride okada for junction
Politician son dey flex for London
One side chop, one side dey suffer
One side dey pray make light recover
Dem say “be patient, country go better”
Na so hunger dey write love letter
Old papa pension never land
Youth frustration full every hand
Dem say “we rise by lifting others”
But na only poor man dey carry another
Chorus — Street Anthem
Which one be One Nigeria?
If my pain no concern my brother
Which one be One Nigeria?
If blood dey drop but dem dey cover
One Nigeria!
But everybody dey on their own
One Nigeria!
Yet the poor man still alone
Soro soke! make dem hear am well
No be by anthem, no be by bell
If we no bleed the same together
Tell me how we be one forever?
Verse 2 — The Genocide Nigeria
Village burn for midnight silence
Children run from bullet violence
Mothers cry but TV no send
Another mass grave, another trend
Some dey die because of their tribe
Some because dem no get power side
If na rich man pikin dem touch
Army go full road sharp sharp much
Life cheap pass politician convoy
Justice dey sleep, evil dey enjoy
We bury truth inside religion
Still dey shout “peace and unity nation”
Verse 3 — The Oppressive Nigeria
Big oga chop money for project
Road no good but budget complete
Dem buy jeep, build mansion taller
Citizen still dey beg for dollar
Election time dem go remember
Share small rice for poor December
After voting, gate go close
Na police and tax we go know
Dem divide us by tongue and region
Use our anger build their kingdom
Then come TV dey preach togetherness
While corruption dey wear agbada dress
Final Chorus / Outro
Which one be One Nigeria?
Three Nigerians dey inside one
The oppressed
The killer
And the silent one
Which one be One Nigeria?
When truth dey hide for every corner
Until justice sit for same table
Unity na poster, no be honor
One Nigeria!
Make e start from equal life
One Nigeria!
No be by force, no be by hype
If one man bleed and you no feel am
That “One Nigeria” na slogan.