Frobits
🎵 A song made on Frobits

God Over Man

0:000:00
Download
Reply with a song
Lyrics

[male vocals] My

helper

Dey

no

wan

help

you,

dem

say

if

dem

help

you,

you

go

too

shine,

dem

sey

if

dem

give

you

award

your

head

go

too

swell

up,

dem

sey

if

dem

give

you

contract,

your

shoulders

go

dey

high

enihow

enihow,

all

na

enihow

capping

and

lapping.

Enibodi

fit

become

king,

nobodi

fit

control

tomorrow,

nobodi

fit

control

him

own

life

and

kpai.

no

laff

enibodi,

no

chase

enibodi

comot.

life

fit

easy

for

some

pipple,

hard

for

some

pipple,

take

am

nwayoly

and

jejely.

Now

wey

baba

god

don

help

me,

dey

come

dey

claim

helper,

now

wey

baba

don

carry

contract

dey

pursue

me,

dey

com

dey

claim

sponsors,

now

wey

baba

god

don

decorate

me

wella,

dey

com

dey

gossip,

dey

yinmu

sey

you

don

dey

do

juju,

dey

claim

sey

you

don

forget

dem.

No

human

being

get

dis

world,

dis

world

no

be

anybodi's

property,

dis

world

no

be

enibodi's

own,

na

baba

god

get

am,

na

him

own.

Baba

god

fit

bless

enibodi

wey

him

wan

bless,

baba

fit

ring

your

door

com

open

eni

door

for

anybodi

wey

him

like.

Haters

com

dey

wait

make

you

fail,

make

you

fall

from

laddar

wey

baba

don

carry

you

put

untop.

Ogbeni

hater,

you

go

wait

tire,

you

go

look

so

tey,

wata

go

carry

you

go

sanko,

go

mind

your

business,

go

smoke,

go

drink

and

relax.

Enibodi

fit

become

king,

nobodi

fit

control

tomorrow,

nobodi

fit

control

him

own

life

and

kpai.

no

laff

enibodi,

no

chase

enibodi

comot.

life

fit

easy

for

some

pipple,

hard

for

some

pipple,

take

am

nwayoly

and

jejely.

Dis

blessing

don

com

to

stay,

dis

egg

no

go

break,

even

if

him

fall,

him

no

go

break,

him

no

go

scatta,

baba

god

hand

dey

am,

angels

dey

guild

am,

demons

no

fit

do

enitin.

He

don

dawn,

he

don

be,

he

go

stay

forever.

Wen

i

dey

waka

upandown

help,

you

dey

laff

me,

dey

mock

me,

dey

tell

pipple

sey

i

no

wan

learn

enitin,

dey

lie

sey

na

so

so

money

i

dey

fine,

sey

my

head

no

dey

inside

work,

dey

lie

give

pipple

wey

wan

help

me.

you

don

forget

sey

baba

god

dey

heaven

dey

watch

you

and

me.

Man

no

be

god,

baba

god

na

god,

him

dey

heaven

dey

watch

my

tears,

dey

hear

my

cry.

now

wey

he

don

see

me,

com

bless

me.

wetin

com

dey

bite

your

yansh,

dey

worry

your

eyes,

nna

face

front,

no

look

me,

i

no

dey

see

you.

Enibodi

fit

become

king,

nobodi

fit

control

tomorrow,

nobodi

fit

control

him

own

life

and

kpai.

no

laff

enibodi,

no

chase

enibodi

comot.

life

fit

easy

for

some

pipple,

hard

for

some

pipple,

take

am

nwayoly

and

jejely.

I

no

offend

you,

i

no

hate

you,

baba

god

don

bless

you,

allow

am

make

him

bless

me

too.

you

don

get

your

own

money,

make

i

get

my

own,

ogbeni!

life

no

hard,

na

hate

make

am

strong

like

stone.

Drive

your

car,

make

i

drive

my

own,

build

your

house

make

i

build

my

own,

marry

your

wife,

make

i

marry

my

own,

born

children,

make

i

born

too,

your

money

na

your

own,

my

own

na

my

own.

dey

your

lane,

make

i

mind

my

lane,

run

my

race,

make

you

no

craze

untop

my

mata.

Help

enibodi

wey

you

get

opportunity

to

help,

love

everybodi,

nobodi

know

wetin

tomorrow

fit

bring.

nobodi

today

fit

be

somebodi

tommorow.

no

laff,

no

mock,

no

beat

am ,

no

chase

am

comot .

enibodi

fit

become

king,

eniday,

enitime.

take

life

easy.

uwa

bu

nwayo

nwayo,

uwa

bu

ofu

nbia.

Enibodi

fit

become

king,

nobodi

fit

control

tomorrow,

nobodi

fit

control

him

own

life

and

kpai.

no

laff

enibodi,

no

chase

enibodi

comot.

life

fit

easy

for

some

pipple,

hard

for

some

pipple,

take

am

nwayoly

and

jejely.

Nobodi

fit

curse

who

god

don

bless,

nobodi

fit

bring

down

who

god

don

lift

up,

nobodi

fit

destroy

wetin

god

don

build.

if

god

no

watch

over

de

city,

watchmen

dey

watch

in

vain,

na

god

dey

untop,

man

no

fit

be

god.

Enibodi

fit

become

king,

nobodi

fit

control

tomorrow,

nobodi

fit

control

him

own

life

and

kpai.

no

laff

enibodi,

no

chase

enibodi

comot.

life

fit

easy

for

some

pipple,

hard

for

some

pipple,

take

am

nwayoly

and

jejely.

More songs by Udehani Listen to songs created by others
FROBITS