[male vocals] Oga
politician
[male vocals] Oga
politician
[male vocals] Oga
politician
[male vocals] Oga
politician
[male vocals] Oga
politician
Oga
wey
dey
chop
our
money,
you
dey
chop
am
yaga
yaga,
dey
chop
am
yaffu
yaffu,
you
don
forget
boys
wey
carry
ballot
box,
you
don
forget
boys
wey
kpai
for
you,
you
don
forget
boys
wey
run
your
mata
wit
iron
and
bodi
bodi.
You
dey
chop
our
money
yaffu
yaffu,
yaga
yaga.
You
fit
kpai
pipple
but
you
fit
kpai
baba
god,
you
fit
run,
but
you
no
fit
hide,
you
fit
deal
wit
pipple,
but
you
no
fit
deal
wit
karmah.
No
worry,
next
three
years
you
go
fine
anoda
boys,
we
dey
wait
for
you
for
street,
you
dey
waka
updown
wit
escots
and
bouncers,
no
wahala,
god
dey
watch
your
steps,
just
dey
watch
your
back,
boys
dey
watch
you.
You
carry
your
pikin
dem
go
kip
for
oyinbo
country,
com
dey
carry
stainless
steel
and
iron
dey
give
boys
for
street
make
dem
go
play
hit
for
you.
Baba
dis
kind
life
no
dey
tire
you,
no
get
conscience,
everytime
go
nak,
go
hit
am,
go
teach
am
lesson.
You
fit
kpai
pipple
but
you
fit
kpai
baba
god,
you
fit
run,
but
you
no
fit
hide,
you
fit
deal
wit
pipple,
but
you
no
fit
deal
wit
karmah.
Baba,
boys
wan
work,
boys
wan
get
family,
boys
wan
drive
car,
boys
wan
work
collect
salary
take
help
dem
life.
we
don
tire
to
smoke,
don
tire
take
sachet,
we
don
tire
to
smoke
kannah,
we
don
tire.
boys
wan
work.
If
boys
tell
you
sey
dey
wan
work,
you
go
dey
capp ,
you
go
dey
snag,
dey
nagg,
you
go
dey
hit
snag ,
dey
sigh,
dey
frown
face ,
dey
carry
face
throw
way.
Dis
life
na
wah
ohh.
Na
we
go
for
street
runs,
na
your
children
good
for
school
and
beta
work.
god
dey
watch
you.
You
fit
kpai
pipple
but
you
fit
kpai
baba
god,
you
fit
run,
but
you
no
fit
hide,
you
fit
deal
wit
pipple,
but
you
no
fit
deal
wit
karmah.
Baba
you
be
knight
for
church,
you
be
elder
for
community,
strong
politician
for
community.
i
swear
sey,
your
children
no
sey
you
dey
kpai
pipple,
dem
no
no
sey
you
dey
rigg
election,
dem
no
no
sey
you
dey
do
bad
bad
tins.
Baba
you
no
get
fear
of
god
wey
you
dey
call
everyday.
You
go
sit
don
for
front
seat
dey
pray
to
baba
god
for
inside
church,
but
your
boys
dey
street
dey
razz
everywhia,
dey
kpai
pipple
pikin,
dey
collect
wetin
no
go
good
for
mind.
I
dey
look
you,
i
dey
fear
you
pass
devil.
You
dey
chop
our
community
project
money,
you
dey
chop
road
money,
you
dey
chop
light
money,
enibodi
wey
talk
go
lose,
enibodi
wey
yarn
wetin
happen
don
price
you,
you
go
deal
wit
am.
You
fit
kpai
pipple
but
you
fit
kpai
baba
god,
you
fit
run,
but
you
no
fit
hide,
you
fit
deal
wit
pipple,
but
you
no
fit
deal
wit
karmah.
Now
wey
you
dey
sick,
you
dey
beg
pipple
sey
make
dem
forgive
you.
sey
make
dem
pray
for
you.
Baba
go
confess
bad
bad
tins
wey
you
don
do
pipple
for
dis
life.
Even
devil
dey
fear
you,
all
boys
wey
work
for
your
house
you
no
dey
gree
pay
dem,
na
to
chop
dere
money,
na
to
kpai
eni
one
wey
challenge
your
evil.
Papa
god
don
remember
you.
You
dey
cry,
dey
beg
pipple ,
baba
god
no
dey
sleep.
[male vocals] Oga
politician