Frobits
🎵 A song made on Frobits

Respect the Hand

0:000:00
Download
Reply with a song
Lyrics

[male

vocals] (

Talking

drum

Respect

and

honour

Respect

pipple

wey

hold

your

hand

wen

sapa

wan

drown

you,

honour

pipple

wey

carri

you

for

back

wen

fear

wan

finish

your

life,

respect

pipple

wey

give

you

light

make

you

see

road

wen

darkness

dey

your

road,

honour

pipple

wey

give

you

ladda

make

you

take

climb

up.

life

no

easi

for

dem

too

bro..

No

faint,

help

dey

com,

no

vex,

angels

dey

carri

your

blessings

dey

com,

no

curse,

baba

god

don

see

your

tears,

no

cry,

becos

you

go

smile

wella

wen

de

blessing

rich

your

hand.

Many

dey

fine

ladda ,

dem

no

see,

many

wey

wata

don

carri

no

see

hand

wey

fit

hold

dem,

many

don

lost

for

dark

roads

of

dis

life

becos

dem

no

see

touchlight,

plenti

don

kpai

becos

dem

no

get

pesin

to

carri

dem

for

back

wen

life

don

tire

for

desert

and

forest.

Bro

humble

yasef,

sista

calm

down ,

life

no

easi

for

de

pesin

wey

carri

you

for

back,

life

no

sweet

de

pesin

wey

gift

you

ladda,

e

no

plenti

wella

for

de

pesin

wey

give

you

touchlight,

no

be

sey

dem

no

get

problem.

Na

only

sey

dem

get

betta

mind

to

help

pipple

wey

need

help.

No

faint,

help

dey

com,

no

vex,

angels

dey

carri

your

blessings

dey

com,

no

curse,

baba

god

don

see

your

tears,

no

cry,

becos

you

go

smile

wella

wen

de

blessing

rich

your

hand.

If

you

think

sey

e

dey

easi,

run

am

for

oda

pipple,

carri

dem

for

back

wen

you

neva

chop,

give

dem

ladda

wen

you

neva

climb

up,

point

touchlight

for

pipple

wen

your

eyes

neva

see

road

wella,

make

i

yarn

de

truth,

my

sista

no

easi

to

get

betta

mind

wey

wan

see

odas

succeed

before

dem.

Sey

na

your

broda

no

means,

e

dey

owe

you

money,

becos

him

be

your

uncle

no

mean

e

dey

owe

you

ladda,

becos

him

be

your

cousin

no

means

sey

him

must

carri

you

for

back,

becos

dem

be

your

parents

no

means

sey

dey

must

kpai

for

dreams

to

come

through.

No

dey

greedy

and

ungrateful,

respect

hand

of

fellowship,

honour

your

lifters

and

helpers.

Life

no

look

rosy

for

de

head

wey

carri

your

matta

for

head

like

chinchin

for

traffic.

De

hand

wey

make

crayfish

bend

na

him

still

make

stockfish

straight.

No

faint,

help

dey

com,

no

vex,

angels

dey

carri

your

blessings

dey

com,

no

curse,

baba

god

don

see

your

tears,

no

cry,

becos

you

go

smile

wella

wen

de

blessing

rich

your

hand.

Now

wey

baba

god

don

butter

your

bread,

na

so

so

insult

you

dey

insult

your

helpers

and

lifters.

You

sey

wetin

dem

do

for

you,

you

sey

dem

be

mere

god's

vessel,

you

sey

wetin

dem

do

wey

anoda

pesin

neva

do.

Sista

fear

god,

that

road

wey

you

trek

pass,

you

go

still

trek

am

com

pass

again.

Respect

am

or

life

go

disrespect

you.

De

pesin

wey

shit

for

market

road,

flies

go

tell

am

welcome

wen

e

dey

com

back.

De

pikin

wey

dem

carri

for

back

no

no

sey

road

far.

Enitin

wey

you

do

odas,

odas

go

do

back,

if

you

dey

disrespectful,

odas

go

disrespect

you,

if

you

honour

odas,

odas

go

honour,

na

so

life

be

my

broda.

No

brag,

no

drag,

no

puff,

no

huff,

no

do

yanga

like

tolotolo,

no

bark

like

bingo,

no

craze

like

gorrila,

no

hiss

like

snake,

no

bleat

like

sheep,

no

hum

like

bee,

no

vex,

no

do

gragra,

no

fine

trouble,

no

go

fight,

no

tear

shirt,

no

shout.

Life

sabi

humble

head

wey

dey

hot

like

fire.

No

faint,

help

dey

com,

no

vex,

angels

dey

carri

your

blessings

dey

com,

no

curse,

baba

god

don

see

your

tears,

no

cry,

becos

you

go

smile

wella

wen

de

blessing

rich

your

hand.

No

swear

for

an

ingrate,

no

curse

ungrateful

pesin,

leave

dem

for

god,

na

god

dey

bless,

na

god

dey

reward

pipple,

Bible

yarn

sey,

blessed

go

be

de

hand

wey

dey

give.

no

put

mind

for

oda

pipple

to

help

you,

na

baba

god

dey

rememba

pesin.

Yestaday

ingrate

fit

be

today

saviour,

today

ungrateful

babbon

fit

be

today

helping

hand.

Just

pray

and

hope,

miracle

no

dey

tire

baba

god,

betta

tins

no

dey

lack

for

good

man

house.

Wen

hope

no

dey,

hope

go

appear

for

betta

man

wey

baba

god

love.

No

fear,

you

no

go

kpai

untop

of

dat

sickness,

no

faint ,

help

dey

come,

no

give

up,

light

go

show,

no

waka

commot

help

dey

waka

dey

com

your

house,

no

think

sey

baba

god

no

dey

see

you.

e

dey

see

you,

he

dey

hiar

you,

he

go

answer

you.

No

faint,

help

dey

com,

no

vex,

angels

dey

carri

your

blessings

dey

com,

no

curse,

baba

god

don

see

your

tears,

no

cry,

becos

you

go

smile

wella

wen

de

blessing

rich

your

hand.

Night

dey

long

for

de

stomach

wey

dey

hungry

wella,

road

dey

long

for

leg

wey

don

tire,

sun

dey

worry

bodi

wey

no

well,

sapa

dey

trouble

pesin

wey

no

get

hope.

Sista

humble

yasef

nothin

dey

dis

life,

odogwu

bring

your

shoulder

down,

your

mates

full

mortuary,

dey

don

form

frozen

chicken

pose.

Otilo,

alaye

calm

down,

stay

humble,

rememba

your

lifters

and

helpers

make

baba

god

bless

you

wella.

No

faint,

help

dey

com,

no

vex,

angels

dey

carri

your

blessings

dey

com,

no

curse,

baba

god

don

see

your

tears,

no

cry,

becos

you

go

smile

wella

wen

de

blessing

rich

your

hand.

More songs by Udehani Listen to songs created by others
FROBITS