[male vocals] For
dis
garage
[male vocals] For
dis
garage
[male vocals] For
dis
garage
[male vocals] For
dis
garage
For
dis
garage,
you
go
see
tire,
you
go
tire
for
wetin
your
eyes
don
see.
inside
this
garage
you
go
see
one
chance,
you
go
tiff,
you
go
see
armed
robba,
you
go
see
pickpocket,
you
go
see
agbero,
you
go
see
mad
pipple,
you
go
see
pastor,
Imam,
mallam
dem
plenty
for
dis
garage
Inside
garage
na
inside
life,
outside
garage
na
yankee,
who
no
dey,
no
come,
who
no
come,
no
collect,
who
no
pay,
no
collect,
who
no
pay ,
no
pay
charges,
no
collect
change.
Na
pesin
wey
see,
na
him
no,
na
still
him
no
wetin
him
see,
if
you
see,
no
talk,
if
you
talk,
you
don
buy
wetin
no
be
your
mata.
anytin
wey
you
see,
na
you
sabi,
na
you
go
buy
market
from
witch
hand.
Na
ashawo
wey
package
well
na
private
chef,
tiff
wey
rebrand
wella
na
yahoo
boy,
native
doctor
wey
change
position
na
prophet,
native
promax
na
seer.
na
who
believe
am
na
him
be
mugu,
de
one
wey
dem
chop
na
mumu.
Inside
garage
na
inside
life,
outside
garage
na
yankee,
who
no
dey,
no
come,
who
no
come,
no
collect,
who
no
pay,
no
collect,
who
no
pay ,
no
pay
charges,
no
collect
change.
Inside
dis
garage
if
you
hear
say
everytin
is
possible,
hold
your
pocket,
change
position.
If
you
no
mount
wella
you
will
walk
alone,
you
go
trek
come
believe
say
everytin
is
possible
for
dis
garage.
Garage
na
life
inside
life,
na
pipple
wey
dey
inside
life,
no
say
life
na
wonders
wey
dey
fear
signs.
If
you
hear,
bring
one
thousand
naira
come
collect
ten
thousand
naira,
my
guy
keep
walking,
no
standing,
no
waiting
just
keep
walking.
No
dulling,
no
sleeping
on
tins,
stay
on
alert,
na
who
sleep,
na
him
lose.
If
you
lose
guard
dey
don
carry
your
iron,
iron
condemn
bobbies
na
ninja
for
garage,
if
you
dull,
dey
don
carry
go
for
dome.
Inside
garage
na
inside
life,
outside
garage
na
yankee,
who
no
dey,
no
come,
who
no
come,
no
collect,
who
no
pay,
no
collect,
who
no
pay ,
no
pay
charges,
no
collect
change.
Beggas
wey
full
garage
na
beggas
wey
no
get
julius
but
dey
fit
construct
your
infomation
pass
goggle,
dem
sabi
de
garage
pass
goggle
map,
na
beggas
for
days,
armed
robbas
for
night,
no
capp,
no
lapp,
no
dulling,
no
sleeping
on
tins.
For
dis
garage,
if
you
no
fit
fight,
no
put
bodi,
if
you
no
fit
run,
no
put
mount,
if
you
no
fit
chest
stone,
no
price
market,
if
you
no
fit
play
witch,
no
form
ninja,
if
you
no
fit
carry ,
no
buy
market.
Face
front
carry
uche
for
bag
dey
waka
jeje.
Inside
garage
na
inside
life,
outside
garage
na
yankee,
who
no
dey,
no
come,
who
no
come,
no
collect,
who
no
pay,
no
collect,
who
no
pay ,
no
pay
charges,
no
collect
change.
I
no
fit
run
no
be
when
olopa
lapp
wit
A
K,
temple
run
na
normal
relay
for
those
ninjas
and
witches.
Dey
run,
dey
jump,
dey
climb,
no
looking
back,
no
paddi
for
dis
jungle,
no
guy
for
inside
dis
garage.
No
dulling,
no
sleeping,
no
throw
way
uche,
carry
akonuche
like
school
bag,
na
who
lose,
na
him
go
understand
why
Igbo
man
dey
Lagos
for
fourty
years
bcos
him
no
say
he
go
beta
one
day.
Fourty
years
na
just
yestaday.
Who
no
come
garage
no
dey
inside
life,
him
dey
outside
life,
if
dem
touch
you,
check
your
pocket,
if
dem
greet
you
wella,
your
phone
don
go,
dem
help
you,
you
don
pay
for
charges
no
collect
change.
Inside
garage
na
inside
life,
outside
garage
na
yankee,
who
no
dey,
no
come,
who
no
come,
no
collect,
who
no
pay,
no
collect,
who
no
pay ,
no
pay
charges,
no
collect
change.