[male
vocals] (
Oya,
listen
now)
You
no
fit (
Oya,
listen
now)
You
no
fit
You
dey
shout,
dey
sweat,
dey
para
upandown...
Bro
No
matta
de
power
wey
you
get
You
no
fit
grab
thunda,
you
no
fit
block
rivar,
you
no
fit
hold
wind,
you
no
fit
smoke
ocean,
you
no
fit
swim
fire,
you
no
fit
swallow
mountain,
you
no
fit
twist
hills,
you
no
fit
bury
rain.
Just
no
sey,
you
cant
stop
me.
No
cry,
no
complain,
no
shout,
no
yinmu,
no
vex
throw
wey
de
blessing
wey
dey
your
hand,
if
he
no
rich
you
today,
he
go
rich
you
tommorow.
Na
so
dis
life
be
my
broda.
If
cloud
no
dey
complain
about
de
sun
and
rain,
if
dust
no
dey
cry
about
de
wind,
if
breeze
no
dey
complain
about
the
ocean,
sand
no
dey
cry
about
legs
wey
dey
waka
untop
of
am.
Rivar
no
dey
cry
about
trees
and
grasses.
Bro,
no
cry
for
my
mata,
face
front.
You
no
fit
stop
de
sun
from
shinning,
you
no
fit
stop
the
rain
from
falling,
you
no
fit
control
de
wave,
you
no
fit
bend
time,
you
no
fit
crop
de
moon,
bro
you
are
sleeping
on
a
long
tin.
if
you
tink
otherwise.
Dem
no
dey
covar
pregnancy
hand,
your
hand
no
fit
covar
de
moon,
you
no
fit
plug
de
stars.
Na
only
bread
fruit
wey
time
don
rich
dey
fall
for
ground.
No
kpai
yasef
for
my
mata.
High
tension
no
be
janglova,
bomb
no
be
bread,
bullet
no
be
biscuit,
no
carri
gun
go
play
for
sand.
Na
baba
God
get
time,
wen
your
time
for
blessing
don
rich,
baba
god
go
bless
you
wella.
No
cry,
no
complain,
no
shout,
no
yinmu,
no
vex
throw
wey
de
blessing
wey
dey
your
hand,
if
he
no
rich
you
today,
he
go
rich
you
tommorow.
Na
so
dis
life
be
my
broda.
You
fit
vex,
you
fix
kpai
yasef,
you
fit
hug
transforma,
you
fit
cry,
you
fit
sit
don
for
ground,
you
fit
sleep,
you
fit
shout,
you
fit
craze,
you
fit
carri
your
head
nak
for
ground.
All
dat
one
no
go
fit
change
time
wen
baba
god
don
rememba
to
bless
you.
Nothin
fit
stop
am.
No
jelous
de
pesin
wey
him
time
don
rich,
no
kpai
am,
no
stop
am,
no
block
am,
no
do
juju
to
block
am,
no
carri
him
name
go
temple
sey
make
dem
burn
candle
for
him
head.
Your
enemi
today
fit
be
your
paddi
tommorow,
today
no
be
everytin,
tommorow
big
pass
today.
Nothin
dey
dis
life,
dis
world
na
small
place,
dis
world
dey
turn,
turn.
You
fit
dey
up
today
com
dey
down
tommorow.
Take
am
easi.
No
cry,
no
complain,
no
shout,
no
yinmu,
no
vex
throw
wey
de
blessing
wey
dey
your
hand,
if
he
no
rich
you
today,
he
go
rich
you
tommorow.
Na
so
dis
life
be
my
broda.
We
don
see
tins,
we
don
hear
tins
too.
Nobodi
fit
stop
time,
nobodi
fit
kpai
destini.
You
fit
delay
destini,
but
you
no
fit
stop
am.
wen
de
time
rich,
e
go
be.
dem
sey,
what
must
be
must
be.
Na
pesin
wey
kpai,
na
him
lose,
na
snail
wey
get
patience
dey
waka
untop
of
chuku
chuku.
No
bodi
fit
catch
thunda,
no
bodi
fit
grab
lightening,
wen
your
time
rich,
your
blessings
go
show
wella.
No
lose
guard,
no
lose
control,
life
na
turn
by
turn,
moon
no
dey
shine
for
afternoon,
sun
no
dey
shine
for
night,
stars
no
dey
show
for
daytime.
Rain
no
dey
disturb
desert.
Every
season
get
him
time.
Na
so
everytin
get
him
time.
No
cry,
no
complain,
no
shout,
no
yinmu,
no
vex
throw
wey
de
blessing
wey
dey
your
hand,
if
he
no
rich
you
today,
he
go
rich
you
tommorow.
Na
so
dis
life
be
my
broda.
Every
season
get
him
blessing,
everytin
get
him
wahala,
all
dey
com
as
baba
god
take
plan
am.
Eni
one
wey
rich
you,
take
am,
wait,
no
cry,
no
shout,
maintain,
na
him
time
be
dat.
If
na
blessing
com
enjoy
am
na
your
time
rich
so,
na
so
life
be
my
sista.
No
cry,
no
complain,
no
shout,
no
yinmu,
no
vex
throw
wey
de
blessing
wey
dey
your
hand,
if
he
no
rich
you
today,
he
go
rich
you
tommorow.
Na
so
dis
life
be
my
broda.