A song made by Paul Shobowale
A song made by Paul Shobowale
Oya, sister mi, ehen
Na you be the blessing wey them dey talk about
This song is dedicated to my sweet junior sister Rebecca ayoola Shobowale
Young but the strength dey flow like river
Wake up every morning, to take good care of her siblings
She no get tiredness, e no get rest
Sister mi dey move like she get wings on chest
Abeg everybody bring your plate, come and line up
Food don ready, she no dey give up,
From the youngest pikin to the oga at top
She dey care for everybody, she carry the family matter for head like Nigeria budget
Nne, nwannem, she be the rock
When the wahala come, she dey unlock
Every door for joy, every path for peace
Her love no get ending, na increase
Rebecca my sister, omo mr Samuel shobowale
You be the light when the darkness dey come
Rebecca my sister, pure of heart
You give your all from the very start
No cap, you be the one, no competition
Every hand you hold, e become vision
My Sister my sister, thank you so much for all you do
Your love dey heal with a holy touch
She dey see the pain before the tears dem fall
Run come with solution, she no dey hesitate
Every sacrifice she make, no be for show
Just pure love action, everybody knows
Siblings dem dey watch am like a queen
Best caregiver wey baba God ever give us
No competition, she no dey compete
Just pouring out blessings, making life sweet
From the cooking pot to the listening ear
Even though say she stubborn small,i still love her to the fullest,
When you need her presence, she appears
Mother figure, sister, friend all in one
Her legacy nah top-notch, she no dey relent
Rebecca my sister, omo Shobowale
You be the light when the darkness dey come
My Sister my sister, pure of heart
You give your all from the very start
No cap, you be the one, no competition
Every hand you hold, e become vision
My Sister my sister, thank you so much
Jomiloju, Abigeal and darasimi are saying thank you ma for your care and motherly love,
Hallelujah, sister mi
May almighty God bless and reward you for us in jesus name ameeeeen