A song made by Ugomma
A song made by Ugomma
Omo, I know my worth, abeg
My glory dey come
Three beautiful girls I born for this man Daniel
Three queens wey born from my body confidence,baby bliss and baby wealth
I work like a man, I sweat like a man
But he chop the glory, leave me the wahala
Everything wey I do, e no see am
But my God dey see, and that one sufficient
I no go cry, I no go break down
Because I know say my better days coming
My tomorrow go shine brighter than today
My tomorrow go shine brighter than today
I done sacrifice, I done struggle hard
But my glory no go pass me by
My tomorrow, my tomorrow
Going be better, better, better than today
I wake up early, I sleep late night
I build this house with my two hands
Yet him dey sit down like him do something
Na only his name wey people hear
But watch me when my time come
Watch how I rise up like phoenix bird
I no go look back, I no go regret
Because I know say better days waiting for me
My tomorrow go shine brighter than today
My tomorrow go shine brighter than today
I done sacrifice, I done struggle hard
But my glory no go pass me by
My tomorrow, my tomorrow
Going be better, better, better than today
Eku ile, new season coming
No more shadows, light breaking through
These three girls watching what I do
I no go fall, I stand firm
I remembered when I sold my blood for peanut just to feed our daughters without any help I borrowed money from my landlord just to see that Daniel successfully got to Ghana .i faced soo many challenges yet I stood my ground
He’s family members chased me and my kids away from their compound yet he did nothing about it After all the battles I fought for him and now the velain God knows how much I have tried to save u but u don’t deserve me all my love for u was all in vain but God will bless u and ur family for the things u all did to me and my kids
My tomorrow dey shine, ehen
Better days coming, no cap
I believe, I believe, I believe