[male vocals] No
laff
anybodi
My
paddi,
this
life
no
dey
stay
for
one
position,
na
so
so
turn,
turn,
turn
this
world
dey
turn,
if
he
turn
reach
you
today,
he
go
turn
reach
your
guy
tommorow.
You
wey
dey
laff
anoda
pesin,
life
fit
turn
com
dey
laff
you
as
you
dey
for
wheelchair.
Wristwatch
no
fit
tell
tomorrow,
car
no
fit
carri
you
enta
future,
jet
no
fit
fly
your
spirit
enta
heaven.
Humble
yasef
nothing
dey
dis
life.
enjoy
your
timeline
jejely.
No
laugh
man
wey
no
get
money
today,
baba
God
fit
bless
am
yafu,
yafu
tommorrow,
he
come
get
money
pass
you,
come
get
moto
pass
you,
come
get
beta
house
pass
you.
pesin
wey
get
money
today
fit
no
come
get
today
and
tommorow
again,
because
money
be
like
birds
wey
fit
fly
away
anytime
wey
another
season
come.
My
paddi
no
laugh
pesin
wey
no
get
pikin,
na
God,
baba
God,
na
him
dey
give
pikin,
he
fit
give
you
gun,
wey
no
get
bullet,
you
get
press
tire
nothing
go
come
out,
he
fit
give
you
bullet,
you
no
go
come
get
gun,
baba
god
fit
come
love
you,
come
give
you
gun
come
join
am
with
plenty
bullets.
God
na
god,
na
so
life
be
my
guy.
My
paddi,
this
life
no
dey
stay
for
one
position,
na
so
so
turn,
turn,
turn
this
world
dey
turn,
if
he
turn
reach
you
today,
he
go
turn
reach
your
guy
tommorow.
No
dey
buka
for
anything,
nothing
dey
this
life,
no
dey
laugh
anyhow,
no
dey
talk
anyhow
to
people,
you
fit
still
no
get
today
and
tommorow.
i
don
see
pesin
wey
get
plenty
today,
the
same
today
government
seized
everything
because
of
crime
wey
another
pesin
commit.
stay
jeje,
jeje
respect
people,
respect
yourself.
My
paddi
no
dey
capp
anyhow,
come
dey
laugh
anyhow,
as
night
dey
come,
na
so
day
dey
come,
sun
come
shine,
moon
come
do
him
own
for
night,
rain
come
fall,
small
time,
hamatan
come
dey
blow.
life
na
turn
by
turn,
tommorow
fit
no
be
your
turn
again,
You
wey
get
bad
belly,
you
fit
no
see
money
today
and
tommorow
because
of
bad
bad
things,
juju
juju
thing
wey
you
don
people.
Na
so
i
talk
am
my
paddi,
na
truth
i
dey
yarn
you
my
guy.
Live
right,
do
beta,
stay
wella,
trust
in
God,
your
turn
go
come.
no
dey
curse
people
wey
don
get
am,
no
dey
drag
people
down,
dey
gossip
lie
lie
against
dem.
My
paddi,
my
guy,
no
laugh
any
persin
wey
dey
sick.
this
life
na
small
place,
wey
be
say
anybody
fit
fall
sick,
if
you
no
fall
sick,
you
fit
get
accident
come
die
before
the
pesin
wey
dey
sick,
another
fit
come
break
leg
or
head.
Na
laugh
pesin
wey
don
old,
old
age
no
be
sickness,
na
blessing
to
see
longevity,
money
and
power
no
fit
buy
am.
if
to
say
dem
they
sell
am,
poor
man
no
go
grow
old.
No
dey
buka
for
anything,
nothing
dey
this
life,
no
dey
laugh
anyhow,
no
dey
talk
anyhow
to
people,
you
fit
no
get
today
and
tommorow.
i
don
see
pesin
wey
get
plenty
today,
the
same
today
government
seized
everything
because
crime
wey
another
pesin
commit.
stay
jeje,
jeje,
respect
people,
respect
yourself.
Live
right,
do
beta,
stay
wella,
trust
in
God,
your
turn
go
come.
no
dey
curse
people
wey
don
get
am,
no
dey
drag
people
down,
dey
gossip
lie
lie
against
dem.
Baba
God
i
knee
dey
beg
you,
give
me
gun,
carry
plenty
bullets
join,
make
i
dey
fire
plenty
children,
children
na
blessing,
no
forget
to
carry
plenty
money
escot
am
come
my
house.
i
no
dey
laugh
anybodi,
i
dey
help
people,
dey
support
my
paddi,
dey
help
my
guys.
Baba
bless
everybodi
for
me,
make
the
gbedu
go
round
and
round,
reach
everybodi.
You
wey
dey
laff
anoda
pesin,
life
fit
turn
com
dey
laff
you
as
you
dey
for
wheelchair.
Wristwatch
no
fit
tell
tomorrow,
car
no
fit
carri
you
enta
future,
jet
no
fit
fly
your
spirit
enta
heaven.
Humble
yasef
nothing
dey
dis
life.