A song made by Nathaniel Suur Stephen
A song made by Nathaniel Suur Stephen
Engineers we made it oh!
From 2021 till now!
We don survive am!
Since 2021 we dey grind oh
Fixed lectures, drilling, wahala plenty
Sleepless nights with calculations
Stress don tire, but we no give up
Lecturers dey scatter our brain
But we dey push, we dey maintain
Tests and exams back to back
But na champions we be like that
We survive am! We survive am!
Engineering no be beans oh!
We survive am! We survive am!
Juniors make una no give up!
We don see am all, we don pass through fire
Now we dey celebrate, we never tire
Your own time go come, just hold am tight
Engineers we made it, we dey alright!
To all the juniors wey dey come behind
Make I tell una, e go dey fine
The road rough, the load heavy
But una fit carry am steady steady
When lecturer dey vex for class
When your result almost no pass
Remember say we don dey there before
Now we dey shine, we don break the door!
We survive am! We survive am!
Engineering no be beans oh!
We survive am! We survive am!
Juniors make una no give up!
We don see am all, we don pass through fire
Now we dey celebrate, we never tire
Your own time go come, just hold am tight
Engineers we made it, we dey alright!
E choke! We made it oh!
Engineers stand up!
No give up! No give up!
We are champions!