A song made by Mayrhy Mercy.
A song made by Mayrhy Mercy.
Hallelujah!
I dey call on You oh
When the road dey rough and I no fit see
When my strength don finish, na You dey for me
Every mistake wey I don make, Lord
Your love still dey cover me, I no go lie
Abeg oh, Father hear my cry
Without Your grace, I no fit survive
My broda, my sista, everybody need am
God's mercy dey sweet pass anything
Your mercy Lord, e dey follow me
From morning reach night, e dey cover me
I no deserve am but You still dey show me
Your mercy Lord, e dey follow me
Glory! Hallelujah!
Your mercy Lord, e dey follow me
When I fall down, You dey pick me up
When I mess up, You no give up
Your love no get ending, e pure like water
Baba God, I need Your mercy for this life oh
Ko si wahala wey You no fit solve
You be my shield, my everything
I lift my hands, I worship You
Your mercy e sweet, e dey renew
Your mercy Lord, e dey follow me
From morning reach night, e dey cover me
I no deserve am but You still dey show me
Your mercy Lord, e dey follow me
Praise God!
Your mercy Lord, e dey follow me
Thank You Jesus!
Your mercy endures forever
Amen!