[male vocals] Africa
Africa
na
my
home,
i
love
am,
i
get
am,
na
our
own,
na
ogbonge
continent
wey
baba
god
carry
give
us,
com
put
us
inside
sey
make
we
dey
jolli,
dey
flex
life
like
ant
wey
enta
sugar.
We
get
plenty
sun
wey
dey
shine
wella,
we
get
plenty
rain
wey
baff
us
wella,
we
get
plenty
trees
wey
dey
shield
us,
we
get
plenty
tins
wey
baba
god
carry
bless
us
wit.
Na
so
we
fine
wella,
we
black
wella,
com
bold
wella,
com
get
brains,
com
get
plenty
bros,
our
body
com
get
plenty
beans
join.
We
no
get
anoda
home,
na
here
we
go
kpai,
na
here
we
go
jolli,
na
here
we
go
flex
till
infinity,
wey
get
eternity.
We
no
dey
carry
last,
our
shoes
shine
wella
for
de
world,
we
get
fine
sahara
desert,
we
com
get
Kahalari
desert
wey
get
pink
lips
wey
dem
pimp
wella
like
fine
bobo.
We
get
plenty
sun
wey
dey
shine
wella,
we
get
plenty
rain
wey
baff
us
wella,
we
get
plenty
trees
wey
dey
shield
us,
we
get
plenty
tins
wey
baba
god
carry
bless
us
wit.
We
come
get
mountain
kilimanjaro
wey
tall
wella,
com
fin
join.
Baba
god
you
too
much,
see
as
you
com
dash
us
beta
Victoria
waterfall
wey
be
like
mama
iwota
kingdom.
We
get
plenty
bush
animals
wey
dey
waka
like
king
wey
get
palace.
Na
so
dem
dey
jolli,
dey
flex
inside
bush,
we
like
dem,
na
so
dey
like
us
too.
We
dey
proud,
we
com
get
pride
for
shoulder
join.
We
no
dey
slack,
we
no
dey
loose
guard,
baba
god
don
bless
us,
don
give
us
boldness
and
plenty
blessings
full
our
brains.
We
get
plenty
sun
wey
dey
shine
wella,
we
get
plenty
rain
wey
baff
us
wella,
we
get
plenty
trees
wey
dey
shield
us,
we
get
plenty
tins
wey
baba
god
carry
bless
us
wit.
We
get
plenty
oceans
wey
dey
bubble,
dey
tumble,
wey
come
get
plenty
crude
oil
and
mineral
resources.
We
get
gold
for
Ghana,
we
get
oil
for
Nigeria,
we
com
get
diamond
for
Congo.
Baba
god
don
bless
us
wella
wella.
Africa
na
beta
home,
africa
na
beta
pipple
full
am.
We
no
dey
forget
our
brodas,
we
dey
help
dem,
we
dey
take
of
our
parents
for
old
age.
We
no
dey
greedy,
we
no
be
gibiti
pipple.
We
sabi
greet
wella,
some
go
dobale,
some
go
shake
hand,
some
go
bow
down,
some
dey
nak
walking
stick
and
fan,
some
dey
wave
demselves,
some
na
kissing
and
pecking.
some
dey
squat
dey
greet.
we
dey
like
greetings
wella.
We
get
plenty
sun
wey
dey
shine
wella,
we
get
plenty
rain
wey
baff
us
wella,
we
get
plenty
trees
wey
dey
shield
us,
we
get
plenty
tins
wey
baba
god
carry
bless
us
wit.
We
get
plenty
universities,
we
get
plenty
diversities
inside
our
old
cities
and
communities,
wey
no
get
minorities,
we
no
get
nonenities.