A song made by Bhig dally 😎🌚🌹
A song made by Bhig dally 😎🌚🌹
Ah ah ah... my baby
You just show for my life oh
I no dey find love that day
I just dey my own sha
Then you comot from nowhere
Catch my heart wey I no fit run
The way you dey look me sef
E be like say na magic
Now I dey wonder how I take survive
Before you enter my life
Baby you too special oh
No cap!
The way you dey love me eh
E choke!
I never see person wey go fit do me like this
You be my blessing, my everything
My unexpected love oh
I love you scatter!
Every morning wey I wake
I just dey thank my God sef
Say e make our path cross that day
You dey patient with me, you dey care
The way you hold me tight
Like say nothing fit separate us
Baby abeg no leave me oh
You don become my oxygen
Baby you too special oh
On God!
The way you dey love me eh
E choke!
I never see person wey go fit do me like this
You be my blessing, my everything
My unexpected love oh
I love you die!
Thank you for loving me oh
Mo gbe!
You be my person for life
Forever baby